Geoffrey Onyeama, Nigeria Foreign Affairs Minister don test positive for coronavirus

Nigeria Foreign Affairs Minister Geoffrey Onyeama don test positive for coronavirus.

Onyeama announce am ontop im twitter handle on Sunday.

According to am, im do im fourth Covid-19 test yesterday afta im notice small irritation for im throat and unfortunately, e come back positive.

Di tweet also say im dey waka go isolate for health facility and go dey pray for di best.

Dis one dey come afta di minister lose im very good friend wey also be di former Chief of Staff to President Muhammadu Buhari, Abba Kyari on di 17th of April.

Onyeama go be di latest top public office holder wey go get di virus.

Govnors Okezie Ikpeazu, Ifeanyi Okowa, Rotima Akeredolu, Nasir El Rufai, Bala Muhammed and Seyi Makinde also test positive for coronavirus.

While di former Govnor of Oyo state Abiola Ajimobi die from complications of Covid-19 on June 25, 2020.

Nigeria as at di time of filing dis report get 36,107 total confam cases of di virus. 778 pipo don die while 14,938 pipo don dey discharged.