Court don cancel EFCC Chairman, Abdulrasheed Bawa jail term ruling

EFCC Chairman Abdulrasheed Bawa show for court

EFCC
EFCC Chairman Abdulrasheed Bawa show for court

One High Court for Nigeria capital, Abuja don cancel one ruling wey convict di Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), Abdulrasheed Bawa for contempt proceedings.

Justice Chizoba Oji on Thursday bin reverse her earlier order of conviction afta one application wey di oga Bawa bring before di court.

For di ruling ontop one motion of notice wey di EFCC file, di application ask di court to stop all di proceedings on di issue between di Federal Republic of Nigeria V AVM Rufus Adeniyi Ojuawo, and set aside di conviction of di applicant for contempt.

Earlier court ruling wey order Bawa go jail

Earlier, di court bin direct di Inspector General of Police to lock Oga Bawa for di Kuje correctional facility, for di Nigerian capital, Abuja pending wen dem obey one court order wey say make di commission return one range rover and di sum of of N40 million naira.

EFCC say dem don return di vehicle but di moni still dey dia hand.

Justice Chizoba Oji wey give di judgement on Tuesday also direct di Inspector General of Police, Usman Baba to make sure say im execute di order of di court sharp sharp.

Di judge bin reject di arguments of di lawyer to di EFCC, Francis Jirbo to justify im client action. 

Local media bin report say na on October 28, wey Air Vice Marshal Rufus Adeniyi Ojuawo file motion on notice.

Marshal Rufus Adeniyi na former Director of Operations for Nigerian Air Force (NAF).

For di motion, di former Director of Operations complain say EFCC no gree comply with di order, for di release of im seized property wey court give for 21 November, 2018.

Di EFCC application wey make di court cancel di earlier ruling

Abdulrasheed Bawa plus im team for court

EFCC
Abdulrasheed Bawa plus im team for court

Di Nigeria anti-corruption police oga bring di application wey dey pursuant to Section 6(6) (a) and Section 36(1) of di constitution of diFederal Republic of Nigeria 1999 (as amended), Section 91 of di Sheriffs and Civil Process Act, Cap S6 Laws of di Federal Republic of Nigeria 2004 and oda relevant enactments wey explain di EFCC chairmo role for di case.

Ruling on a motion on notice wey di EFCC file wey want make di court quash di entire proceedings for Suit No. FCT/HC/CR/184/2016 between Federal Republic of Nigeria V AVM Rufus Adeniyi Ojuawo, and set aside di conviction of di Applicant for contempt, Justice Oji say she find merit for for di application in di interest of justice.

E beg di court to cancel dia earlier decision as im don already comply wit di court order. 

Court judgement

For her ruling, Justice Chizoba tok say di new evidence before her show say Bawa no dey in contempt of di court, for di time she give di order. 

She see say Bawa don already order di return of di Range Rover Sport vehicle to di applicant, Mr Rufus Ojuawo.

”I hereby set aside di entire contempt proceedings for Suit No. FCT/HC/CR/184/2016 between di Federal Republic of Nigeria v AVM Rufus Adeniyi Ojuawo.

‘’Dat I further set aside di conviction of di Applicant, di Executive Chairman, Economic and Financial Crimes Commission, for contempt unconditionally,” she rule. 

Who be AbdulRasheed Bawa

Abdulrasheed Bawa

EFCC
EFCC Oga Abdulrasheed Bawa

AbdulRasheed Bawa na trained EFCC investigator wey get orishirishi experience for di investigation of advance free fraud mata, official corruption, bank fraud, money laundering, plus oda kains of economic crimes.

Im na di youngest EFCC oga since dem create di commission for 2003 and one of di first cadet officers EFCC bin get for 2005.

Part of im achievement be say im be di chief investigator for di alleged multi-billion naira fraud case against former Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke.

E come from Kebbi state and dem born am for 1980.

Di EFCC oga na Certified Fraud Examiner (CFE), Certified Anti-Money Laundering Specialist (CAMS) wey don collect training for United States Federal Bureau of Investigation (FBI), United States Financial Crime Enforcement Network (FINCEN).