Burundi President Pierre Nkurunziza don die

Pierre Nkurunziza

Getty Images

Burundi President Pierre Nkurunziza don die at di age of 55 of heart attack according to goment sources.

Burundi goment announce di death of President Nkurunziza through statement wey dem publish for di official Twitter handle.

Dem say im die of heart attack yesterday afta doctors no fit resuscitate am.

Dem bin admit 55 years old Nkurunziza for Karusi hospital on Saturday night afta im bin attend games for one stadium near im house.

Goment announce seven days national mourning wey start from today Tuesday.

Oga Nkurunziza lead Burundi since 2005 and bin dey prepare to handover power to di newly elected president Evariste NDayishimiye on August 20, 2020.

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.