End SARS protest: Channels TV Headquarters shut down transmission temporarily sake of ‘threat’ of attack

Channels TV headquarters for Lagos southwest Nigeria don shut down transmission temporarily on Wednesday sake of attack on ‘threat’ to dia staff and operations.

After dem bin go off air around 12:00pm, dem scroll say “Dem dey stop transmission temporarily because of threat of attack on dia staff and operations.”

Di TV station wey don come back on air now but dey show recorded programmes for now.

Although Channels TV don come back on air now, dia going off air come some hours afta hoodlums burn anoda TV station wey base for Lagos, Television Continental, (TVC).