Lucky Aiyedatiwa na deputy or acting govnor of Ondo State? President Tinubu tok as court give judgement

Following di intervention of President Bola Tinubu, di Ondo State House of Assembly don tok wetin be di resolution as Govnor Rotimi Akeredolu no gree handova power give im deputy, Lucky Aiyedatiwa.

President Tinubu bin meet wit executives from Ondo State last week sake of di wahala wey dey rock di state since Gov Akeredolu no gree resume back to di state afta e arrive Nigeria from medical leave.

Pipo wey go di meeting include speaker of di Ondo State House of Assembly, Ọladiji Ọlamide, Deputy Govnor Lucky Aiyedatiwa, chairman of di All Progressives Congress (APC) Abdullahi Umar Ganduje and many odas.

For di meeting, President Tinubu bin tok some tins wey di executives and lawmakers for Ondo State gatz make sure say e no happun.

For di statement wey di chairman of house committee on Information Hon. Olatunji Oshati bin release, di President no tok say make di deputy govnor resign but na say make im no dissolve any office for Akeredolu back.

Part of wetin President tok be say make di deputy govnor no dissolve di state executive council.

“Say make di party leadership and structure remain intact and dat di House of Assembly leadership go remain intact too.”

As many pipo dey ask if Aiyedatiwa go still be deputy or acting govnor since Akeredolu no dey around, di resolution wit President Tinubu be say make “Hon. Lucky Orimisan Aiyedatiwa kontinue to dey perform di functions of di office of di deputy govnor”.

Court judgement ova Aiyedatiwa impeachment

For Thursday afternoon, di Court of Appeal wey sit for Abuja dismiss di appeal against di interim order wey dey stop di impeachment plot of di deputy govnor Aiyedatiwa.

Di Ondo State House Assembly bin plan to impeach di deputy govnor bifor. For 26 September 2023, Justice Emeka Nwite being order say make dem stop di impeachment process against di deputy govnor.

Di House of Assembly bin go Court of Appeal to appeal di judgement wey say make dem no impeach di deputy govnor. But di Appeal Court don dismiss di case sake of say di state don dey get solutions to dia political problem.

Remi Olatubora (SAN) wey move di notice of withdrawal for 30 November tok say all di parties wey dey involved don find solutions to dia problems. Counsel to di deputy govnor, Adegoke Adewusi and odas no raise any objection.

Deputy govnor Aiyedatiwa head executive meeting

For di midst of di wahala, di deputy govnor Aiyedatiwa return to head di Ondo State Executive council meeting.

E dey preside ova di meeting as vice chairman of di council, not as acting chairman becos dem no hand-ova power of acting govnor to am.

Dis executive meeting dey come afta plenti months wey Aiyedatiwa don face serious gbas-gbos from evri angle including di impeachment saga from di House of Assembly.

According to statement wey comot from di office of di deputy govnor, “di meeting fit be indication say di political disagreement for di state fit don come to an end”.

E dey expected say di official outcome of di meeting go reach di public as evribodi still dey watch if Akeredolu go return to govern di state or e go hand-ova give im deputy as acting govnor.

For dis moment, Aiyedatiwa na still deputy govnor of Ondo State as govnor Akeredolu no hand-ova power to am.

Wetin constitution tok about incapacitated govnor

So wetin be di constitution stand on wen govnor of a state dey incapacitated?

Section 189 of di 1999 Constitution as amended say, na wen govnor or im deputy “no dey capable of discharging di function of im office”.

To prove say im dey incapacitated, di House of Assembly go need to set up medical panel wey go do necessary medical examination, give dia report to di Speaker.

If di medical panel certify for im report say di sickness wey im dey suffer don render am permanently incapable of discharging di function of im office, Section 189 (2) say di speaker go sign and publish di notice for Official Gazette of di goment of di State.

From den on, di govnor or deputy govnor no go fit hold di office again from di date wey dem publish dat gazette.

According to section 189 (subsection 1-5) of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, di govnor or deputy go cease to dey hold power if e dey verified say dem dey incapable of discharging dia functions.

Di section add say wia e dey certified say di govnor or deputy dey suffer from any infirmity of bodi wey make am incapable of discharging function of im office, e go cease to hold power.

Section 190 of di constitution also tok on why e dey necessary for govnor to transfer power to im deputy if e dey unable to perform im function.

Di section say di deputy go become acting govnor wen di govnor write to di House of Assembly say im dey go vacation or unable to function well.

All of dis na wetin Akeredolu don violate, according to wetin ogbonge lawyers tok.

Even as im transfer power give im deputy for sometime, e collect am back but e neva return to di same state e dey govern.

Source