Big Brother Naija season 5 housemates and eviction: Di ‘relationship, situationship and entanglement inside di lockddown house

Relationship, situationship and entanglement na wetin fans dey take describe some of di hook ups wey dey happun inside di Big Brother Naija season 5 lockdown house.

Na just eight days wey di housemates don spend for di house but already some of some of dem don mark dia territory.

See some of di ‘relationships’ wey fans dey tok about for di reality television show.

Entanglement?

One of di most talked about relationship inside di house na di one between Ozo, Nengi and Dorothy

On Sunday during di Live eviction show, Ebuka ask Ozo about im relationship with di ladies, im say Dorothy na im friend inside di house e add say im dey attracted to Nengi.

Meanwhile Dora bin don already tell Ozo earlier in di week say “I no like dis situation and I go remove myself from am,” na wetin she tell Ozo.

Relationship

“Even though I know say I want to dey involved with a lady when I enta di game, I no expect us to dey dis close dis fast,” na wetin Eric tell Neo.

Eric and Lilo begin dey close to each few days afta dem enta di house. Di two of dem dey always spend time togeda for di house.

On Saturday dem share dia first kiss togeda for inside di reality show.

Situationship?

Di oda relationship wey surprise fans well-well na between Neo di Warri boy and Vee di London girl.

Neo tell Eric about im own situationship palava, for inside di house but e make am clear say dis love mata wey im dey about to enta no go distract am from di Big Brother game.

E say, “Your own no quick pass my own.” Na wetin Neo tell Eric.

“She don already set her mark, she ask me to be her bestie and give her a massage.” Na wetin im add put.

Meanwhile di oda relationship wey fans dey look with side eye for di house na di Kiddwaya, Erica and Wathoni circle.

Kiddwaya and Erica don begin gum each oda. On Friday wen Erica bin dey cry inside room Kiddwaya go console her.

But e be like say Wathoni like di 27 year old from Benue, afta dia Saturday night party during dia truth and dare game im kiss Wathoni.