Blast in Kano: How gas explosion kill nine pipo for Kano

Plenti pipo

BBC

Dem don confam say di number of causalities for one explosion for di northern state of Kano state don increase from four to nine pipo.

Na Nigeria ministry of humanitarian affairs confam dis one say dem recover victims from di rubble of di building wey di blast occur.

Di explosion also affect di outside of one school wey close to di place.

Before now, Kano State Police bin tok say na four pipo die for di explosion wey happun for Sabon Gari area of Kano, Northern Nigeria.

How e happun

Investigation dey go on but initial reports say na gas cylinder from one welder shop cause di explosion.

Di Kano state commissioner police CP sam’ila Dikko tok say, “no be bomb explosion, na gas cylinder explosion. We know dis because one of di first victims na welder for di area”.

E add say, “four pipo lose dia lives wey include three men and one woman but we neva find student wey be victim of di explosion.”

Sabon Gari Market President President Nafi’u Nuhu Indabo tell BBC Hausa di tori say e affect plenti pipo wey include school pikin dem for di area.

Pictures and videos from di incident full social media today dey show how pikin dem dey cry and pipo as dem dey put hand for head on top of di building wey collapse sake of di explosion.

Kano goment react

Pipo

BBC

Di state Commissioner for Information ask pipo wey dey live for di area to dey calm and collabo with goment authorities for investigation.

For statement, Malam Muhammad Garba say, “di incident bin happun for animal feed shop opposite one school for Aba road Sabon Gari area of Fagge local government”.

Malam Garba also add say di goment go continue dey inform di public on any informate for dis mata and tell pipo make dme no dey spread tori wey dem neva confam.

Meanwhile Kano state deputy govnor, Nasiru Gawuna don visit di scene of di explosion.

Kano na di most populous city for northern Nigeria.

For plenti years, Kano don dey largely spared from di extremist group Boko Haram.

But about ten years ago one massive bomb attack by Boko Haram kill more dan 100 pipo in one mosque for di city.

map

BBC

Nigeria don face plenti explosions for long no be today.

For April, one illegal oil bunkering site for Im state explode and many pipo bin die.

Also na explosion, armed men take stop di Abuja Kaduna train for march wia t least eight pipo die for di attack.

For January 2022, gas tanker explode for Ughelli for Delta state wey kill at least two pipo.

See more fotos from di scene:

Place wia di exposion happun

BBC
Police say dem neva see any victim from di school yet
plenti pipo

BBC
Plenti pipo

BBC
rubbles

BBC