Cameroon news: Hospital chase comot victim wey no fit pay bills afta Yaoundé Rond Point Damas explosion

Kontri pipo don forget say local bomb bi explode for Rond Point Damas, (Damas Junction) for Yaoundé-Cameroon, life don turn to normal, pipo di buy and sell for de explosion spot.

For July 2, local bomb, (pressure pot wit eight and six-inches iron rod weh deh bi tie’am for motorcycle battery) bi explode wound five pipo.

One pesin weh de explosion remain for e mind and skin na Nke Prisca, mami for seven pikin, victim weh fire from de explosion burn.

“Dat day, we no bi see or suspect any tin, ah bi di sell plum and bobolo, de bomb dey for ma back.

“Pesin weh e bi wan buy bi stand for ma front, as ah give e plums di wan take moni, ah only hear na explosion, ‘kpooo'”.

“Ah bi first check say na electric pole catch fire, ah hide wan hide under table, ah see fire for ma clothes, na dat taim ah dive for ground, all man bi di fall for ground and even de man weh e bi wan buy plum”.

Dis explosion bin bi na three, afta de first two for Melen and Emana inside two weeks for Yaoundé weh e put capital city under security alert.

Na so deh bi take Prisca go hospital, for wusai e don make three weeks.

“De first days for hospital no bi easy, deh di tie me napkin laik small pikin, na ma massa and ma mami di carri me up for ease ma sef”.

“Den, deh take me for theatre clean ma skin weh e bi just di high, afta deh clean de wound wit salt solution, put pomade”, Prisca tok.

Na Prisca e mother-in-law kam take e grand pikin dem go village, e massa and mami di look-out yi for hospital.

“Dis accident don worry me, school go start, ah nova get moni for komot for hospital, no moni for send pikin dem for school”, Prisca di worry.

Ah bi di find moni for ma pikin dem, make deh get chop, no tief, but see me today, Prisca add.

Hospital di drive victim as e no fit pay bill

Since weh Police bi kam leave me for emergency unit for Central hospital here, na all dat, Prisca tok.

Good heart pipo helep and family try for pay for treatment, as for three weeks we don spend $ 364 (FCFA 200,000).

Hospital discharge Prisca, but e get for pay FCFA 115,000 bill weh e remain for total $533 (315,000) before e komot.

Ah just dey for hospital, deh no di give me any oda treatment again.

“If you no komot, we go give you anoda bill. Afta 10 days you go pay $39 (FCFA 22,000), also, you get for komot as we need bed for put anoda patient”, Prisca tori weti nurse tell e.

Prisca e massa don go for social affairs unit, meet-up director for hospital, Prof. Fouda, but help no dey.