Hushpuppi arrested: Nigerian, Raymond Igbalode or Ramon Olorunwa Abbas wey FBI wan sentence for fraud dey MCC Chicago, Federal Bureau of Prisons BOP in Chicago, Illinois USA

Di Federal Bureau of Prisons BOP for America latest news on Hushpuppi arrest na say di Nigeria Instagram celebrity wey FBI arrest for fraud dey MCC Chicago, Federal Bureau of Prisons wey be prison in Chicago, Illinois USA.

Hushpuppi or Hush wey real name na Ramon Olorunwa Abbas or Ramon Olorunwa Abbas (according to BOP details), bin chop arrest for Dubai before dem extradite am go US after dem arrest am for fraud alias advance-fee scam.

Di Federal Bureau of Prisons upload Hushpuppi name for BOP website on Monday night.

Di prison don put Hushpuppi prison registration number, 54313-424, wey go make pipo fit search am for BOP website.

BOP also put im name, age and race.

US Department of Justice go transfer di 37-year-old Hushpuppi go Los Angeles to go face criminal charges for di coming weeks, according to wetin BBC Pidgin Daniel Semeniworima find out.

Mark Geragos – American criminal defense lawyer fit be Hushpuppi lawyer but BBC Pidgin not fit independently verify dat tori.

Di Extradition of popular Nigeria social media celebrity, Ramoni Igbalode AKA Hushpuppi and Lekan Ponle AKA Woodbery to di United States sake of internet crime accuse don cause plenti tok for social media space.

Dubai police bin arrest di two alleged internet hackers plus 10 oda pipo for one operation wey dem call ‘Fox Hunt 2’.

Di operation take down di suspects for committing crimes outside di UAE, including money-laundering, cyber fraud, hacking, criminal impersonating, scamming individuals, banking fraud and identity theft.

From di operation, Dubai police gbab documents of one planned fraud wey worth 435million dollars.

Di Director of Dubai CID say from di raid, dem gbab document of one planned fraud wey dey worth $435 million.

Dubai police say dem also seize:

  • More dan $40.9 million cash moni
  • 13 expensive cars wey worth $6.8 million moni wey dem get from mago-mago activities
  • 21 computer device
  • 47 smartphones
  • 15 memory stick
  • Five hard disk wey contain 119,580 fraud files
  • Address of 1,926,400 victims.

On Thursday di Dubai police say dem don handover Hushpuppi and Woodbery to di Federal Bureau of Investigation (FBI) for America for prosecution.

Biography of Hushpuppi

Who be di Hushppupi or Hushpuppi parents, Hushpupi girlfriend na still kwesions wey pipo dey ask worldwide;

See wetin we sabi

  • Husppuppi born year na 1983, according to prison details.
  • Im real name na Ramoni Igbalode Abbas, dem born am for June 14.
  • From reports wey we gada, dem born and raise am for Lagos wey be Nigeria commercial capital.
  • Hushpuppi girlfriend: Reports bin dey say Hushpuppi date Amira Dyme wey be German model and dia two meet for Dubai.
  • More dan 50 Facebook accounts dey registered wit Hushpuppi name and all of dem dey suggest say im come from different cities for di kontri.
  • Hushpuppi dey popular for Instagram sake of di way im dey showcase expensive cloths, cars, shoes and even travels.
  • Till Dubai police dem arrest am for June 2020 , Ramoni dey live for Dubai.
  • One of di Facebook account wit di name ‘Raymond Hushpuppy’, e claim say im come from Nsukka, e dey live for Enugu and im go school for Imo Satate University for Owerri. E no dey clear if dis na di true identity of Ramoni Igbalode as oda facebook accounts dey suggest different schools and different place of birth.
  • For di last post wey im share before dem arrest am, he showcase one 2021 white RollsRoyce Cullinan wey worth ova $320,000.

https://www.instagram.com/p/CBFrPgjj5cx/

  • For im official Instagram accout, Ramoni claim say im be Real Estate Developer.
  • He bin also dey into fashion wen e travel to Malaysia to stay before im later move to Dubai.