System upgrade by Nigerian banks leave many customers stranded

Pipo wey dey bank

Getty Images

Nigeria banks dey shut down dia systems for upgrade, but dis upgrades don affect many customers.

As at Friday, queues for bank dey long and internet banking wey pipo suppose rely on dey slow.

Customers both online and offline dey lament ova di system upgrade as e dey delay salaries, utilities bills, among odas.

Guaranty Trust Holding Company Plc (GTCo) announce say dem go close early for dia branches for major system upgrade dis week.

GTB tok say dem plan to upgrade to Finacle Core Banking Application System from October 11 to October 13 and dem go reopen on October 14.

Di bank tok say dem go get 11-hour service downtime on October 13, wey fit affect customers digital and internet transactions.

“We go like to inform you dat all our branches nationwide go close to customers early on Friday, October 11th, 2024 as we begin di transition to new and robust suite Finacle Core Banking Application Systems,” di statement tok.

From time to time, banks need do platform upgrade to improve security and make banking processes smoother, di banks tok.

Also, Access bank bin announce give dia customers say dem go upgrade dia system.

Di bank later announce dem postpone di system upgrade but still customers dey complain about dia slow digital and internet transactions on social media.

“We wish to inform our valued customer say di previously announced system upgrade, initially scheduled to start on Saturday, October 12, we don postpone. We go communicate new date for di upgrade in due course,” di statement tok.

A week ago, customers of Zenith bank experience difficult banking network but di bank tok say dem don restore dia performance.

Many pipo para sotay dem almost begin attack di bank, social media videos show. Di bank don since return to offer normal banking services.

Failed transcations for banks depsite e-banking

Many banks for Nigeria dey transfer large amounts of sensitive customer data to anoda data space, while many dey fear di vulnerabilities of dia transactions during dis period.

However millions of bank customers, working class, roadside small businesses and traders dey fear becos dem no get cash for hand to run dia lives and banks no dey close to wia dem dey live.

Ayo, wey be Zenith bank customer tok say becos of di money wey e neva collect for di past 48 hours e neva chop and still Zenith bank neva respond to am afta di failed transaction on October 8.

“I dey fraustrated, I no get anytin to chop. Dem send money from Palmpay to my account since October 8. I neva see di money and Palmpay say di transcation dey successful. Zenith neva tok anytin.”

Anoda customer wit Access bank, Temitope Feffi share her experience about how di downtime wey delay di payment of her staff salaries for days and e don also affect her own personal business transactions as event planner.

“Di pipo wey I send money neva receive di money wey I send, but fortunately some don receive di money but odas neva see di money,” she tok.

“I send di money multiple times to di bank but no dey successful. I get pipo wey I wan pay as event planner but I neva pay dem and e don make me sick like dis.”

Central Bank of Nigeria begin campaign for e-banking to ease transactions, efficient services and support cashless policies for di economic growth.

Dis incidents fit make customers begin habour dia money for house and no carry am go keep for house becos of di sensitivity of transactions and access to dia money

Source