Nithi bridge accident: 12 pipo including two pikin die for Kenya crash

Police officers inspect incident site after one truck and two cars crash for di Nakuru-Eldoret highway wit at least 8 casualties for Nakuru city of Kenya on December 31, 2023.

Getty Images
Kenya police

Kenyas dey mourn di death of Twelve pipo, wey die for one road accident wey happun for di Nithi Bridge area, Tharaka Nithi County.

Tharaka Nithi police say, pipo wey die include two pikin dem, eight women and two men.

Tharaka Nithi police commander Zaccheus Ng’eno confam di accident wey involve one private Toyota Hiace wey dem hire to go Nairobi and one Toyota Hilux wey dey drive towards di Chogoria.

“Na anoda dark evening wey we don get dis kain accident. We dey confam say we recover 12 bodies from di scene, and two oda wound,” Ng’eno tok.

Di oga for di county police say di tragic crash involve two vehicles wey bin dey go head to Nairobi and Meru.

Di pipo wey die for di Hiace na group of friends wey bin dey go back to Nairobi afta dem attend dia friend parental blessing ceremony for Meru.

Billionaire and founder of Mombasa cement for Kenya Hasmukh Patel don die

Wetin make Kenya youths go back to di streets as Ruto swear in new cabinet

Me-ow! Wetin to know about goment cat tax plans wey dey make pipo para

Ng’eno add say di driver wey bin dey drive di vehicle wey dey go Nairobi no sabi di road well-well.

Im comot from im lane and collide wit di oncoming car wey dey go Meru.

“Preliminary investigations show say di motor vehicle wey bin dey come from di Meru no dey use di road evritime.

We fit assume say di driver no use im lane as expected na why di head-on collision happun,” Ng’eno tok.

Two survivors dey hospital-Police

Tori be say two pipo survive di accident but dem get different degrees of wound. Dem carry dem go hospitals for Chogoria and Chuka.

Di police draw ear give drivers to dey veri careful, especially wen dem dey pass new roads wey dem no sabi..

Tharaka Nithi County Fire and Rescue Department official Alex Mugambi also confam di accident.

Oga Mugambi warn members of di public make dm stop to dey gada around accident scenes, as e dey make rescue efforts hard and e dey also increase di chances of more accidents.

Dis no be di first time accident like dis dey happun for di Nithi bridge area.

Many years ago, at least 45 pipo bin die wen one bus plunge fall from bridge enta inside river for eastern Kenya.

Di bus bin dey travelling to di Indian Ocean port city of Mombasa wen di accident happun for evening.

Tori be say di high bridge wey pass thru di Nithi river for eastern Kenya get plenti black spots.

Source