All you suppose know about Paris 2024 Paralympic Games

About 4,400 athletes from across di world go take part for 22 sports

EPA
Dis na di medals for di Paralympics wey feature braille for one side

Di Paris 2024 Paralympics go begin dis week, ahead of di games we don put down evritin you suppose know about di Games.

Paris go host di Paralympics for di first time for wetin many believe say e go be ogbonge sporting event.

About 4,400 athletes from across di world go take part for 22 sports.

Wen Paralympics dey start?

Di Paralympic Games go begin on Wednesday, 28 August 2024 wit di opening ceremony.

For di first time, e go happun for outside stadium, during di ceremony, athletes go parade pass some of di most iconic landmarks for di French capital wey dey located along di route between di Champs-Elysees and di Place de la Concorde.

A total of 23 gold medals go dey decided for di opening day of competition, Wednesday, 28 August.

Di final day of di Games na on Sunday, 8 September 2024, na dat same day dem go do di closing ceremony too, and medal events like wheelchair basketball, powerlifting, Para-canoe and also Para-marathon events for athletics dey for dat date too.

Which venues dey host di Paralympics Games?

Many of di venues wey dem bin use for Olympics go also stage Paralympic events.

Dem go play wheelchair tennis for Roland Garros, di picturesque Chateau de Versailles garden go be di venue for di Para-equestrian events while di Stade de France go host di Para-athletics programme.

Di Grand Palais, normally na venue for art and sport events, e go host wheelchair fencing and Para-taekwondo while di blind football competition go dey for specially built stadium for di foot of di iconic Eiffel Tower.

And di Para-triathletes go compete through di centre of Paris – di swim element dey due to take place for River Seine.

How to watch di Paralympics games?

Di Games go dey live for SuperSport on DSTV if you dey reason to watch am for Nigeria and Ghana.

Wetin be di new sports for Paris Paralympics?

Unlike di past two editions of di Games wia Para-triathlon and Para-canoe (Rio) and Para-taekwondo and Para-badminton (Tokyo) bin make dia debuts, no new sports dey included for Paris programme.

But dem don expand di badminton and taekwondo programmes dem. Also, dem get a record number of medal events for women.

How many gold medals dey up for grabs for Paris Games?

549 gold medals dey up for grabs from 22 different sports.

Nigeria dey compete for Paris Paralympics?

Nigeria bin finish for number 33 position for medal table

Getty Images
Folashade Oluwafemiayo win gold for Nigeria for powerlifting for Tokyo games

Nigeria go compete for four Paralympic sports events.

For Tokyo, Nigeria finish for number 33 position for di medal table behind fellow Africans Tunisia, Algeria and Morocco wey dey for 28, 29 and 30 position for table.

Team Nigeria collect 10 medals for Tokyo, four golds, one silver and five bronze.

Nigeria sports minister Senator John Enoh say dem don review dia bonus template, and promise to give 15,000USD, 10,000USD,and 5,000USD for Gold, Silver and Bronze medal winners respectively.

Dis, according to di Minister na big difference from wetin dem offer to give athletes for di just concluded Olympic Games wia dem bin promise di athletes 5,000USD, 3,000US and 2,000USD for di winners of Gold, Silver and Bronze respectively.

Nigeria go pin dia hope on powerlifter wey go wan add to her gold medal wey she bin win for Tokyo.

Athletes from Russia and Belarus go take part for Paris Paralympics?

Athletes from Russia and Belarus dey allowed to compete for di Games as neutrals.

Both nations chop suspension from Paralympic competition since Russia invasion of Ukraine for February 2022.

Source