Olympics football 2024 – How men and women teams fit qualify for knockout

Olympics football 2024

Getty Images

Di final round of matches for di group stage of 2024 Paris Olympics for men and women go take place dis week .

Men go play dia final group match on Tuesday while di women go play dia own di next day wey be Wednesday.

For di men, 13 teams go battle out di six remaining spots to join Japan and Spain for di quarter-finals.

While for di women, Spain and United and States of America don qualify for di Knockout rounds afta dem win dia two group matches.

Di top two for each group for di women go qualify as well as di two best third – placed teams. While for di men tournament, di top two teams go qualify for di quarter- finals.

So who fit make am? Make break am down hia for you.

Full football fixtures of 2024 Paris Olympics

Men (Group A)

Men's Olympics football group A

BBC Sport

France go qualify wit a victory or a draw. Even a defeat fit see dem through, unless USA also beat Guinea, in dat case, di three teams on six points go need to dey separated by goal difference.

New Zealand result must better pass USA result for dem to progress. If both of dem win, di group go dey decided on goal difference.

Tuesday July 30

Group A: New Zealand v France, Stade de Marseille, kick-off 6pm

Group A: USA v Guinea, Stade Geoffroy-Guichard, Saint-Etienne, kick-off 6pm

Group B

Men Olympics football group B

BBC Sport

Ukraine need to win to secure dia last eight place. If both group matches end for draw, den goal difference go come into play.

Argentina go qualify wit a win or a draw.

Morocco need a win or a draw to send dem through, unless both games dey tied, in dat case goal difference go come into play.

Iraq must win if dem wan reach di quarter-finals.

Tuesday July 30

Group B: Ukraine v Argentina, Stade de Lyon, kick-off 4pm

Group B: Morocco v Iraq, Stade de Nice, kick-off 4pm

Men's Olympics football group c

BBC Sport

Dominican Republic must win and hope say Egypt chop beating, wey go see di group second position to dey decided on goal difference.

Uzbekistan don comot.

Spain don already qualify for di last eight, and dem go top di group wit a win or a draw.

Egypt dey set to join dem for quarter-finals, but dem fit dey eliminated on goal difference if dem lose, and Dominican Republic win Uzbekistan.

Tuesday July 30

Group C: Dominican Republic v Uzbekistan, Parc des Princes, Paris, kick-off 2pm

Group C: Spain v Egypt, Stade de Bordeaux, kick-off 2pm

Men Olympics football group D

BBC Sport

Israel must win and hope say di game between Paraguay and Mali end for draw. Goal difference go come into play for di event of a victory for di African side.

Japan don already book dia place for di knockout phase.

Paraguay go qualify wit a win. A draw go dey enough, unless Israel win Japan.

Mali must take all three points to get any chance of progressing. Dat scenario, coupled wit a win for Israel, go see di two fate dey decided by goal difference.

Tuesday July 30

Group D: Israel v Japan, Stade de la Beaujoire, Nantes, kick-off 8pm

Group D: Paraguay v Mali, Parc des Princes, Paris, kick-off 8pm

Women ( Group A)

Women Olympics football group A

BBC Sport

Colombia – Go qualify for top two wit draw against Canada

France – Go qualify for top two wit a win/draw against New Zealand AND Canada draw/loss against Colombia

Canada – Go qualify for top two wit a win against Colombia AND if New Zealand draw/loss against France

New Zealand – Go qualify for top two wit win against France AND if winner dey for Canada against Colombia AND if dem finish wit better goal difference

Wednesday July 31

Group A: New Zealand v France, Stade de Lyon, kick-off 8pm

Group A: Colombia v Canada, Stade de Nice, kick-off 8pm

Group B

Women Olympics football group B

BBC Sport

USA – Already don qualify for di quarterfinals and dem go qualify as group winners wit a draw against Australia

Germany – Go qualify for di top two wit a win/draw against Zambia AND Australia draw/loss against di U.S.

Australia – Go qualify for top two wit a win/draw against U.S. AND Germany draw/loss to Zambia

Zambia – Go qualify for top two wit a win against Germany AND if Australia loss to U.S. AND if dem finish wit better goal difference

Wednesday July 31

Group B: Australia v USA, Stade de Marseille, kick-off 6pm

Group B: Zambia v Germany, Stade Geoffroy-Guichard, Saint-Etienne, kick-off 6pm

Group C

Women Olympics football group C

BBC Sport

Spain – Already don qualify for quarterfinals. dem go qualify as group winners if dem draw against Brazil

Japan –Go qualify for di top two wit a win/draw against Nigeria AND if Brazil draw/loss against Spain

Brazil – Go qualify for top two wit a win against Spain AND if Japan draw/loss to Nigeria

Nigeria – Go qualify for top two wit a win against Japan AND if Brazil lose to Spain AND if dem finish wit a better goal difference

Wednesday July 31

Group C: Brazil v Spain, Stade de Bordeaux, kick-off 4pm

Group C: Japan v Nigeria, Stade de la Beaujoire, Nantes, kick-off 4pm

Di quarter- final round of matches go begin Friday August 2 -3.

Source