Who go win Euro 2024? Experts drop dia prediction

A split image of England's Jude Bellingham, France's Kylian Mbappe, Netherlands' Virgil van Dijk, Spain's Lamine Yamal

Getty Images
England, France, di Netherlands and Spain dey eye di final of Euro 2024

Four teams dey prepare for di semi-finals of Euro 2024, Spain go face France on Tuesday di following day England go jam di Netherlands.

Spain dey hope to win di tournament for di fourth time, di last time dem win na for 2012.

France last win am 24 years ago while di Dutch victory happun for 1988 – for England dem dey hope to end dia wait for a first men European Championship.

So which team dey form for dia semi-final, and who fit win di title?

BBC Sport ask experts from each kontri for dia prediction.

‘Spain don show say dem get layers’

Spain players celebrate their victory against Germany

Getty Images
Spain come through a tough game against Germany to reach di semi-finals

Spanish football journalist Guillem Balague:

Spain play three different styles against Germany.

We play wit wingers, den without wingers and without striker and den finally 4-2-4 for extra time, dis one show say we get layers. Di main tin na say we adapt to anytin wey Germany give us. Yes we for lose, but we bin neva dey far away from winning too.

Although for our four previous opponent we bin strong pass dem but no be against Germany. Di koko be say we no give up and we get di victory, so na different test, one of resilience, faith for on our idea, collaboration and insistence, and we come out of am well.

Na also very physical game; di highest number of fouls in a game for European Championship since 2016, but we show say we no dey fear.

We show say we fit play safe, wen we dey ahead, Wen Fullkrug enta di game, dem begin cross ball inside di box and we bin drop too deep. Our team set up to defend; maybe we fit learn from dat becos to dey too intimidated and hide for your own box no be for us.

Against France we know say we need to attack, like wetin we do against Italy, Albania and Georgia. We go need to dey careful against counter-attacks, di same way as we bin do against all our opponents. We dey good to stop dem, dat na why na we commit di largest number of tactical faults.

I know say for France to win dem no need to play well, so e dey important to dey focused di whole game becos dem go dey look for moment of brilliance from dia front men. We go need to dey careful against France pace, wit di likes of Ousmane Dembele and Kylian Mbappe.

Maybe we no dey as sharp as we suppose be for front, but becos we dey press well-well and dey shoot, dey attack and create opportunities, eventually we go crack di nut and I feel say dat go happun against France again.

We get suspensions, and Pedri get injury for di last game, but no huge difference between our best player and our ‘worst’. Na team wey dey behave well all di time as a group, and dem dey flexible, dem sabi read di game well no mata wetin happun for pitch.

I feel say we go beat France and meet England for final.

WINNER: Spain

‘Despite dia modest performances England na contenders’

England players celebrate their penalty shootout win against Switzerland

Getty Images
England beat Switzerland for penalty shootout to reach di last four

BBC Sportchief football writer Phil McNulty:

England must show say di team fit lift dia game to beat di Netherlands, dia performance must improve and dem must rise pass di individual brilliance from Jude Bellingham and Bukayo Saka wey carry dem reach di semi finals.

Gareth Southgate side don really struggle for Euro 2024 against sides wey dey defend deep, so di more attacking approach of di Netherlands fit just suit dem and give England creative players more room to show working.

England go need to dey dia best defensively becos di Dutch dey dangerous for attack, especially wit Liverpool Cody Gakpo wey dey enjoy himself for dis tournament and Memphis Depay wey dey unpredictable and dangerous.

If England get am right dem fit worry Netherlands defence wey dey shake wen dem dey under pressure, di potential battle between di two captains Harry Kane and Virgil van Dijk na key component.

Kane bin struggle well-well for England quarter-final against Switzerland, physically im bin dey look tired and im bin no dey look sharp for attack, but you no fit still bet against am to take di big chance if one come along.

England now, despite dia performances wey dey one kain so far, dey in a position wia dem be serious contenders to win Euro 2024. Dem don reach di semi-finals almost in spite of dia performance, but surely confidence go dey grow and teams dey always feel say luck dey dia side for dis stage of major competitions – tink of Greece for 2004 and Portugal for 2016.

If England win dia first major trophy since di 1966 World Cup, dis no go surprise me – but my sixth sense dey tell me England, my head say na Spain.

Spain look like di best team for dis mixed Euro 2024 although dem fit lose against di talented but regimented France under Didier Deschamps.

None of France players don score goal from open play while Spain dey look sharp wit Lamine Yamal, wey now be 17 years until di day bifor di final, na revelation for side wey also boasts world-class talent in di shape of figures like Manchester City Rodri.

Spain get a potent mix of youth and experience, dem don grow into di competition and na dem be di most impressive team from the start – but I believe say dem go need beat England to win Euro 2024.

WINNERS: Spain.

‘Mbappe go become Mbappe again’

Kylian Mbappe gestures during a Euro 2024 game

Getty Images
Kylian Mbappe don score one goal so far for Euro 2024 – na penalty against Poland for di group stage

French football journalist Julien Laurens:

We don see di best of France defensively, certainly. Dis na wetin dem dey do, na dia style and e dey dia DNA. Na also how to win tournaments, to dey solid defensively.

Di area perhaps wey dem no dey at dia best na wit di ball. Dem no dey play sexy football, No be wetin dem dey about – but dem dey struggle in terms of creating chances. Usually dem dey more effective for di opposition box.

Along wit Cristiano Ronaldo, Kylian Mbappe na possibly di biggest disappointment for dis tournament.

Although some explanations as to why, di first na di mask wey im need to wear afta im break im nose against Austria. For dat game im bin dey look sharp. Im also get small fitness issues before di Euros, so I no think say im dey fully fit – but di mask also dey really bother am.

If e get one team to frustrate Spain more dan any oda hia, na France.

For me, Spain problems for midfield na sake of Pedri injury e go be case of who go win di battle for middle. Di physical impact France midfield get dey incredible, any team wey win dat battle go win di game.

Dis go be a big game for Antoine Griezmann sake of say im don spend most of im career for Spain pass France, so we need him and Mbappe to raise dia game.

I want a France-England final and I feel say France, out of all di four semi-finalists, dey strong and get di experience at dis level. I also think at some point Kylian go become Kylian again and im go dey unbeatable.

WINNERS: France

‘Time dey run out for England & Netherlands’

Wout Weghorst celebrates as the Netherlands beats Turkey

Getty Images
Wout Weghorst na useful weapon from bench for Netherlands

Dutch SoccerNews.nl football writer Jesper Langbroek:

I feel say Turkey game show say di Netherlands get good Plan B – as dem use Wout Weghorst as striker and Memphis Depay just behind.

England bin play wit five defenders against Switzerland, so e make am very tight for dat area. I feel say na di way we need to play if we need to do am.

Di tin I noticed wit dis team na say dem need a wake-up call to ginger dem self. Dem bin get dat against Austria and den against Romania dem play well. Den dem get another wake-up call wen Turkey bin take di lead for di quarter-final.

Dis two teams get more to offer but e neva come out yet – and dat na di similarity between di sides.

I feel say di winner go come from di oda side of di draw. England and di Netherlands neva really dey tested; dem don face some good teams but dem neva play di big kontris sake of say dem dey di oda side of di draw.

I feel say Spain go win becos dem dey play good football as a team. England, France and di Netherlands still dey wait make eviritin gel togeda but time dey run out.

WINNERS: Spain

Source