Zinedine Zidane leave Real Madrid for second time as manager

Zinedine Zidane

Getty Images
Zinedine Zidane had one year remaining on his Real Madrid contract

Manager Zinedine Zidane don leave Real Madrid for di second time for im coaching career.

Real fail to win any trophy dis season and city rivals Atletico Madrid beat dem to pipped to di La Liga title on a dramatic final day on Saturday.

Real tok for statement say dem “must now respect” Zidane decision.

Dem thank Zidane, 48, for im “professionalism, dedication and passion over di years and wetin im mean to Real Madrid”.

Former France forward Zidane, wey play for Real from 2001 to 2006, win three consecutive Champions League titles and one La Liga title for e first period as manager between 2016 and 2018.

Im leave for May 2018, but return 10 months later and secure second La Liga title last season.

“Zidane na one of Real Madrid great icons and im legacy extend beyond wetin im don achieve as coach and player for our club,” na so di Real Madrid statement tok.

“Im dey aware say e get place for di hearts of Real Madrid fans and im go always get home for Real Madrid.”

Real finish two points behind Atletico for La Liga as dem fail to win a trophy for di first time since 2009-10.

Dem suffer early exit from di Copa del Rey for di hands of third division side Alcoyano and lose to Chelsea for di Champions League semi-finals.

Earlier dis month, Zidane, wey get one year wey remain for e contract, deny reports say e bin don inform e squad say im go leave at di end of dis season.

Zidane na di only manager to win di Champions League three times, and di trophies wey im win for Real also include two Club World Cups, two Uefa Super Cups and two Spanish Super Cups.