Bola Tinubu ‘no get issues’ presidency react to di fall for Democracy day celebration

President Bola Tinubu ‘no get issues’ afta im fall during di Democracy day celebration, di President office tok.

Bola Tinubu miss im step and fall as im bin dey waka enta di car wey go carry am go inspect di parade for Eagle Square for Abuja on Wednesday.

President Tinubu wey be 72 years fall inside di vehicle bifor im aids rush to help am stand back up.

Dada Olusegun, special assistant to di president on social media say: “Mr President miss im step as im bin dey climb enta di truck for June 12 Democracy Day celebration and trip. Na mild misstep.’’

‘’Im immediately carry on wit di ceremonial rounds. No issues.” Olusegun add.

One video wey don go viral for social media show di moment di president miss im step and fall inside di truck.

Afta di fall, di President quickly regain im balance and continue wit di event.

Di ceremony for Eagles Square na key event as part of di series of celebrations wey dey happun nationwide to mark Nigeria annual Democracy Day.

Tinubu closest challenger during last year election, Atiku Abubakar, don sympathize wit am

“I sincerely sympathise wit President Bola Tinubu ova dis unfortunate incident as im bin prepare to review di parade on Democracy Day. I hope say all dey well wit am,” Im write on X.

Popular politician and activist Shehu Sani say no be big deal, im add say dat tin wey happun show say di president no different to anyone of us.

“No be Just President Tinubu, anybody wey dey alive fit trip and fall; E don happun to President Biden and Fidel Castro bifor. Presidents na human beings and mortals.”

X user Arinze Odira say di fall dey “scary to watch”.

Another Nigerian Charles Awuzie post for Facebook say im bin dey emotional afta im see di clip.

“Weda na President Biden or President Tinubu, I usually dey feel somehow wen human hurt demself for dia place of service. I wish di president well.”

Special Adviser Information and Strategy to President Tinubu Bayo Onanuga say ‘’President Tinubu no be Superman. Na human being just like all of us. President Biden several times don slips in di last three years. Even di younger Barack Obama bin slip wen im be President. Political leaders na human being too. Dis slip no suppose detract us from di import of Democracy Day celebration’’.

While most Nigerians bin sympathise wit am, odas dey question im health status, wey im opponents bin raise during di campaign for last year general election.

I sincerely sympathise with President Bola Tinubu, over this unfortunate incident as he was set to review the parade on Democracy Day. I do hope that all is well with him. -AA

Posted by Atiku Abubakar on Wednesday, June 12, 2024

Source