Police free American rapper Nicki Minaj afta dem gbab am for Amsterdam airport

Nicki Minaj

Getty Images

Police don free American rapper Nicki Minaj afta dem detain am for Amsterdam Schiphol Airport.

Dutch police bin posted on X: “We just release one 41-year-old American woman wey we bin arrest dis afternoon at Schiphol on suspicion of exporting soft drugs.”

“Di suspect chop fine and fit continue her journey.”

Di artist suppose fly to Manchester for one concert at di Co-op Live venue on Saturday evening.

Minaj bin film part of her encounter wit police, and post am on social media.

For di video, one police officer tell Minaj: “You dey under arrest.”

At Co-op Live on Saturday evening, thousands of fans – many bin wear her trademark pink – and bin dey in good spirits as dem enter di venue, and hope say di show go go ahead.

One start to dey chant: “Free Nicki Minaj!”

Fans Georgina Warde and Darcy Nicholls, both 18, bin travel from Newcastle and bin don dey look forward to di show since dem buy dia tickets for December.

Dem tok say dem go vex if di show no happun.

Ms Nicholls say: “I dey try stay positive but we don accept di fact say e fit no happun. We dey mentally prepared for dat.”

Even witout any legal problems, di rapper dey known for turning up late.

“I really hope she come on,” Ms Nicholls add. “But na Nicki so we bin know e go dey delayed somehow.”

Di music star bin post a series of messages on X apparently in relation to di incident.

“Dem take my luggage witout consent,” she write in one. In anoda she add: “Dis na Amsterdam btw [by di way], where weed dey legal,” using a colloquial term for di drug cannabis.

Minaj bin dey originally scheduled to go on stage at di Co-op Live arena at 20:00 BST.

Doors to di concert bin open around 30 minutes late on Saturday. Thousands dey di venue as of 20:30, e dey unclear weda di gig go go ahead as planned.

But one manager at di venue tell BBC News say di concert go go ahead, and add say one helicopter dey wait for Manchester Airport to bring di rapper to di venue.

E dey technically against di law to possess, sell or produce drugs for Netherlands. But di kontri operate a policy of toleration towards di sale or possession of small amounts of some drugs.

Di BBC don approach Minaj representatives for comment.

Who be Nicki Minaj?

Nicki Minaj

Reuters

Onika Tanya Maraj-Petty aka Nicki Minaj na 41-year-old rapper wey dem born for Trinidad and Tobago but base for di United States.

She bin start her music career for 2004 but she drop her first studio album, Pink Friday for 2010. Di album wey feature songs like “Right Thru Me”, “Moment 4 Life” bin enta number one spot for di US Billboard 200 chart.

Pink Friday bin bring her first Grammy nomination for 2012 under di Best Rap Album, Best New Artist and Best Rap Performance categories.

Though she no get any Grammy, she don win oda awards including American Music Awards, BET awards, BET Hip Hop Awards, Billboard Music Awards, MTV Video Music Awards, MTV Europe Music awards, People’s Choice Awards, Soul Train Award, and Teens Choice Awards.

For 2013, she bin sit as judge for di twelfth season of American Idol.

She bin also do some acting for di first time for 2012 wen she act for di popular cartoon feem, Ice Age: Continental Drift. Oda feems wey she act inside na The Other Woman for 2014 and Barbershop: The Next Cut for 2016.

Source