670 pipo dey buried under Papua New Guinea landslide – UN

Papua New Guinea landslide

Getty Images

Estimate of about 670 pipo dey buried under one massive landslide for Papua New Guinea, UN official tok.

Local officials and aid groups say one huge landslide bin strike one village for Papua New Guinea highlands on May 24, and dem fear say many pipo fit don die.

Head of di International Organization for Migration for Papua New Guinea, Serhan Aktoprak, tok say di impact of Friday landslide for di Enga province plenty pass wetin dem bin dey tink.

“Estimate of 150-plus houses now dey buried,” Oga Aktoprak tok.

Di affected areas na di highlands of Enga, for di north of di island nation for di south-west Pacific.

Oga Aktoprak tok say rescuers bin dey at risk becos “di land still dey slide”.

“Di water dey flow and e don create big risk for evri one wey dey involved,” e tok.

Papua New Guinea landslide

Getty Images
Pipo gada for di site of one landslide for Maip Mulitaka for Papua New Guinea Enga Province on May 24, 2024.

Close to 4,000 pipo dey live for di area wey di landslide hit.

But Care Australia, di humanitarian agency wey dey help wit relief efforts, warn say di number of pipo wey dey affected “fit rise” sake of di influx of pipo wey dey escape tribal conflicts for neighbouring areas.

At least 1,000 don dey displaced sake of di disaster.

Oga Aktoprak tok say gardens wey get grown food and water supplies almost dey completely wiped out.

Di landslide happun around 03:00 local time on Friday (17:00 GMT on Thursday), wen most pipo dey sleep.

Oga Aktoprak tok say pipo wey dey help dey use evri necessary means to recover victims: “Pipo dey use digging sticks, spades, large agricultural forks to remove di bodis wey dey buried under di soil.”

By Sunday, na only five bodis dem don recova alongside di partial remains of anoda.

Wreckage from di landslide, wey include large boulders, trees and displaced soil, dey up to 8 metres (26ft) deep for some areas.

Na only one highway dey into Enga Province and Care Australia tok say debris bin fall across large swatches of di road, wey don limit access to di rescue site.

AFP news agency tok say large machinery dey expected to arrive on Sunday.

Australia Prime Minister Anthony Albanese, tok say im kontri ready to help “our brothers and sisters for Papua New Guinea”.

Tribal violence along di key route dey threaten to scata relief efforts, according to Oga Aktoprak.

Papua New Guinea military dey provide security for convoys wey dey transport aid.

Oga Aktoprak say kasala wey dey happun for di area no get anytin to do wit di landslide wey happun.

“In one day alone, a total of eight pipo don die, dem burn down five business stores and 30 houses,” e tok.

Papua New Guinea get population of more dan 11.7 million pipo plus 850 indigenous languages. Di kontri na di most linguistically diverse kontri on Earth, according to di World Bank.

Source