Mercy Chinwo carry five social media users go court ova allegation say her pikin belong to Nathaniel Bassey

Gospel singer Mercy Chinwo don carry five pipo go court sake of say dem use dia social media pages to spread lie about her and her son.

Di five pipo go appear for court to ansa questions ontop di false posts wey dem make say na Nathaniel Bassey bin get di pikin wey she born for her husband.

Di magistrate court for Wuse zone 2 Abuja don summon di five suspects make dem appear for court on 23 April, 2023.

Mercy Chinwo and her husband Pastor Blessed sue di five pipo through dia lawyer Pelumi Olajengbesi wey be managing partner of Law Corridor wey dey based for Abuja.

According to di complain, di actions of di five defendants amount to intimidation, lies and e don cause injury to dia name.

‘Nathaniel Bassey dey sad and veri disturbed’ – Lawyers tok as dem take action against four Nigerians

Popular gospel singer and instrumentalist, Nathaniel Bassey, bin also write to di Inspector General of Police ova four pipo wey e say write criminal tin about am online.

Nathaniel Bassey write to IGP Kayode Egbetokun say make dem prosecute di four pesin wey im don identify say dem defame am say im be di father of pikin of anoda gospel minister, Mercy Chinwo.

Last week, some pipo bin dey share screenshots of posts wey dey carry informate about di gospel singer say di pikin of Mercy Chinwo bin resemble am.

Dis na afta Mercy Chinwo Blessed and her husband bin post di picture of dia pikin for different social media platforms on Friday 29 March 2024.

Di singer say dat kain lie fit break marriage and dose wey dey behind di post suppose serve as lesson to odas.

Nathaniel Bassey through im lawyers Peter Abraham, Uche Matthew, Gbenga Agunloye, and Anthony Abia bin write one petition to di IGP on 1 April 2024, according to local tori pipo Channels.

According to di petition, Nathaniel Bassey dey sad and dey very disturbed to find say di four suspects get criminal intention to destroy im image and character.

Wetin pain di gospel singer be say di post wey trend online dey accuse and call am “di father of minister Mercy Chinwo Blessed son,’ woman wey dey married to anoda man”, dem tok.

“Our client na gospel music minister wey im songs and ministrations don impact di life of so many pipo around di world” di lawyer write for di petition.

Di petition tok say one X user “wey dey verified bin quote di statement wey one of di social media users bin write, im come add screenshot of di post and add, “Wen we go do di DNA test?”

Di lawyers say di posts by di four of dem na to destroy di image of dia client (Nathaniel Bassey) and if dem no deal wit dem, dem go kontinuu to dey destroy di good name of di gospel minister.

Di lawyers say di actions of di four individuals dey against sections 373 and 375 of di Criminal Code Act and Section 24(1)(b) of di Cybercrimes (Prohibition, Prevention, etc.).

“We wan make you use your good offices to investigate dis matter, arrest, and bring di suspect to justice, wey go serve as lesson to odas.”

Nathaniel Bassey na di convener of di popular #HallelujahChallenge wia pipo dey pray and praise for midnight.

Nathaniel Bassey bin visit Mercy Chinwo and her husband afta dem born dia pikin and return to Nigeria for 2023.

Source