Wetin be di new MenFive vaccine wey fit stop Meningitis

Meningitis patients

Getty Images
Pipo wey bin dey for Infectious Diseases Hospital for Kano wia dem bin dey receive treatment Meningitis treatment for 1996

Nigeria don become di first kontri to receive di new meningitis vaccine wey land di kontri on Tuesday evening.

Di MenFive vaccine come from di Gavi-funded global stockpile, wit one shipment wey Unicef deliver.

Mengitis na one od disease wey dey affect mostly children especially for Northern Nigeria.

Dem go use doses of di vaccine to tackle di meningococcus C outbreak, for di kontri, di organization tok.

Authorities dey target to vaccinate around one million children for six local goment areas for Jigawa state.

Di local goment areas na: Babura, Birniwa, Gagarawa, Gumel, Maigatari, and Sule Tankarkar.

Wetin be di MenFive vaccine

Di MenFive vaccine dey protect against di five main serogroups of meningococcal meningitis wey dey impact Africa.

Di meningococcal serogroups na A, C, W, Y, and X. Na di only vaccine wey dey protect pesin against serogroup X.

Dr Tokunbo Oshin, wey be di Director of High Impact Kontris for Gavi, di Vaccine Alliance tok say “Wit outbreaks of infectious diseases wey dey rise worldwide, new innovations like MenFive dey important well-well to help us fight back.

“Thanks to vaccines, we don stop big outbreaks of meningitis A for Africa: now we don get beta weapon to use respond to oda meningococcal meningitis serogroups wey still dey cause large outbreaks wey dey also result to long-term disability and deaths. “

Gavi go dey work closely wit di Nigerian goment and our partners like Unicef and WHO to support di response to dis outbreak.”

Gavi develop di MenFive vaccine through one collabo between PATH and Serum Institute of India for 13 years.

And dem get support with support from di UK Goment Foreign, Commonwealth and Development Office.

Dem dey also supports outbreak response campaigns for kontris wey no too get money (lower-income kontris).

Na di World Health Organization International Coordinating Group on vaccine provision dey mange requests for di stockpiles.

Na dem also give approval make dem send 1,043,377 doses of MenFive to Nigeria afta di West Africa kontri request for di vaccine.

Gavi bin don work wit kontris to support vaccination against meningitis A, wey reach nearly 400 million children thru campaigns and routine immunisation.

Dis efforts help Africa defeat meningitis A, and dem no see any new case since 2017.

As dem bring MenFive into health system e dey possible say di oda circulating serogroups fit also end one day.

Meningitis vaccination Uganda

Getty Images
Pipo line up to take Meningitis vaccine for Uganda

Wetin be Meningitis and how e be for Nigeria now

Meningitis na deadly disease wey dey affect both small children and adults.

According to sabi pipo Health line for one publication say e dey cause inflammation of brain and spinal cord membranes and na infection dey cause am.

Most times na viral infection dey cause am but bacterial or fungal fit cause am too, according to di World Health Organization.

Someof di symptoms na headache, fever and stiff neck.

Depending on wetin cause am, meningitis fit go by imsef while some fit kill pesin. E also need urgent antibiotic treatment.

Recently, Yobe State goment bin put 206 pipo for isolation sake of di outbreak of cerebrospinal meningitis for three local goment areas.

Tok-tok pesin for di State Sulaiman Gimba bin confam to local media say out of di 206 pipo, 20 pipo die for Potiskum, Fika and Fune Local Goment Areas.

E no end dia o as di Commissioner for Health for Gombe State, Dr Habu Dahiru, bin tok say six pipo die for di state sake of dis disease.

Di pipo wey die na students of Science Technical College, Government Girls Science Technical College, and Federal Government Girls College, for Potiskum Local Goment Area.

“We don already programme mass statewide vaccination campaign and e go start as soon as di state take delivery of di required drugs. Dem don already order for di drugs.” im tell local tori pipo Punch.

Source