Senegal set presidential election date and wetin you need to know

Macky Sall

Getty Images

Di President of Senegal Macky Sall don announce say di kontri presidential election go take place on 24 March.

Dis dey come afta di Constitutional Council rule say e dey unlawful for elections to hold afta President Sall tenure expire on 2 April. Di council bin reject proposed election date of 2 June.

President Sall bin earlier tok say elections go hold for December afta im postpone am from 25 February.

Senegal bin experience political unrest as protests happun for di kontri sake of Sall postponement, wey many pipo see as ploy to keep imsef for power beyond im tenure.

Pipo see Senegal as one of di most stable democracies for Africa.

Na di only for mainland West Africa wey neva experience military coup.

“Di President of di Republic inform di Council of Ministers say di date of di presidential election don dey set for Sunday 24 March,” di council of ministers tok for one statement.

Bifor Wednesday announcement, authorities bin don attempt to postpone di original 25 February poll to December, wey result in deadly unrest for streets.

But di Constitutional Council later rule say di presidential election gatz take place before 2 April.

Earlier on Wednesday evening, Mr Sall dissolve di goment and replace Prime Minister Amadou Ba wit Interior Minister Sidiki Kaba.

E make di replacement sake of say Mr Ba, di ruling coalition presidential candidate go fit focus on im electoral campaign, di presidency tok.

President Sall don serve two terms as Senegal leader and wen dem first elect am for 2012 im promise say im no go overstay.

How di kasala for Senegal take start?

For February, President Macky Sall bin announce di postponement of di February 25 election. Im reason na sake of di fight fight about di kontri presidential candidates list.

Dem arrest ova 200 pipo ova protests wey follow di postponement and even temporarily shut down internet access for di kontri say e dey cos public unrest.

Dat one still no do anytin to stop di protests for wetin kontri pipo tok say go bring shame on dia presidential record.

Heavy protest rock Senegal as lawmakers bin agree to postpone di presidential election.

Di lawmakers bin postpone di election to December 15 wey lead to serious kasala for di assembly wey dem throw out opposition parties.

Protests for Senegal

AFP
Protesters dey run for front of mosque for Dakar as security forces throw dem tear gas

Even though oga Sall tok say e no get plans to run for re-election, critics bin hala say dis move na ploy to hold on to power or influence who go come afta am.

While di election dey hold bifor April wen Sall presidential term dey end, di gbege wey lead to di polls to dey postponed for di first place still full ground.

Dis include allegations of corruption for di Constitutional Court and objections from opposition candidates wey don dey excluded from di candidates list wey dey published last month.

To hold di elections wit di candidates list wey get issue fit renew kasala and violence by supporters of dose wey dem no allow to contest, in particular Ousmane Sonko, wey dey popular wella among young Senegalese.

Most candidates no bin dey campaign since President Sall issue im 3 February decree, hours bifor campaigns suppose kick off.

Senegal for long be one of di most stable democracies for di region – as many see am.

Na di only kontri for mainland West Africa wey neva get military coup. E don get three largely peaceful handovers of power and until earlier dis month neva delay presidential election.

Source