From pick pockets to kidnapping, killing – how crime gradually return to Abuja Nigeria seat of power?

Image of pipo wit weapons

Getty Images

Di recent kidnap of one Alhaji Mansoor and im six daughters on Tuesday night for dia house for Bwari Area Council, Abuja on 2 January, 2024 don spark fresh tok-tok about di return of insecurity to Nigeria Federal capital territory.

Insecurity for Nigeria don turn anoda tin especially for Abuja – in recent times.

Di FCT Police Command bin don give assurances to residents say make dem go about dia legal duties and make dem no fear.

“Di Commissioner of Police FCT Haruna Garba, wish to reiterate im unflinching commitment to make sure say di FCT remain a safe and peaceful place for residents to stay witout fear from any quarters of di Territory,” Police tok inside of one dia recent statements wey tok-tok pesin Josephine Adeh sign.

But di reality be say di more police give assurance di more dis crimes dey happun.

One security expert wey follow BBC Pidgin tok suggest some ways wey dis crime go fit reduce.

Oga Mike Ejiofor wey be security expert tell BBC Pidgin say di insecurity no dey affect Abuja alone, and Abuja na part of Nigeria.

E say di jaguda pipo wey dey do dis tin no dey do am sake of economic issues for di kontri.

Im dey wonder say “if na true -true na hunger or suffer dey make dem kidnap pipo, why dem dey kill dia victims even afta some families don pay ransom?” im ask.

Oga Ejiofor add say dis jaguda pipo aim na to bring down any goment so dat di pipo go begin fear.

“I personally dey worry too say dis tin dey happun for di seat of goment, somtime ago we bin tok about Nasarawa, Niger, Kaduna and Kano and neigbouring states, but see am now e don enta di Federal Capital Territory.

Dem dey try to make goment unpopular to undermine di confidence wey pipo get for goment.

Goment bin don give plenti assurances on di use of technology, but e be like say di technology wey dem deploy no dey work well.”

Im explain say di only solution to dis crime wey dey happun for for goment to localise police.

“Police no get enof manpower, dem no dey fund dem properly, so make we get state police, so dat di state govnors wey be di number one security officer go take charge of dia states, but dis one dey for National Assembly hand, dem need to make law wey go establish state police.”

Oga Mike Ejiofor wey be former Director General State Security Service (SSS) explain say di new trend wey most states and communities dey use to fight crime wey be local vigilante dey good and effective but dem dey limited sake of say local vigilante no dey carry arms.

“Di arms wey vigilante dey carry na arms wey dey easy to get lincense for, but dis jaguda pipo dey carry AK47, AK49, Rocket launcher, so how you expect dem to confront dis jaguda pipo wey carry dis kain arms?” im ask.

Mike Ejiofor say anoda way to reduce crime na for goment to liberalise firearms to some of di established vigilante groups and make police monitor dem strictly so dat dem no go abuse am.

Im add say citizen get dia role to play too, “if anybodi see anytin make dem tok sharp sharp.

Wetin dey happun for FCT?

Gunmen kidnap 10 pipo for inside Sagwari area of Dutse for inside di FCT on 7 January, 2024

Getty Images
Gunmen kidnap 10 pipo for inside Sagwari area of Dutse for inside di FCT on 7 January, 2024

Between 2022 and early 2024 plenti criminal activities don happun for di Federal Capital Territory (FCT).

From small small crimes like pick pockets, e enta alleged disappearance of male and female sex organs, wey police bin tok say nobody don come out wit evidence to say dia vital organ miss.

Abuja still dey face issues of banditry, one- chance and more recently kidnapping and death.

One of di most recent cases of one chance na di death of one young lady Greatness wey enta one-chance motor for Abuja.

Recently, di FCT Police Command for statement say dem parade one couple wey dem arrest as One -chance suspects.

On Sunday, 7 January, gunmen wey wear military camouflage attack one Estate wey dey inside Sagwari area of Dutse, in Bwari Area Council of di FCT, and kidnap pipo wey dia number reach 10.

Di victims include a mother and her ffour children and two staff of a guest house wey dey inside di estate.

A staff of di estate wey no wan mention him name tell BBC say di attack happun around 7.30 for evening and di attack dey very fast, e no even reach 30 minutes.

Wen BBC visit di estate, we see police patrol vehicles as e dey go round, but residents tok say na becos of di attack na im make police show face.

“Bifor, na only di estate vigilante dey provide security for here, and dem no dey carry gun, na only big sticks and matchet dem get,” di guest house staff tok.

Nabeeha Al-Kadriyar and her sisters kidnap

Reports of di kidnap and death of Nabeeha begin trend on Nigeria social media for di weekend, wey make many pipo para say goment no deliver on dia promise to end insecurity sake of di crowd funding.

According to one post wey one X handle, @Adamu_Asiya wey claim to be dia family member post on X, she say dem kidnap Alhaji Mansoor and im six daughters on Tuesday night for dia residential house for Bwari area of Abuja, di kontri capital on Tuesday, 2 January.

“Abeg make una pray for my sisters and uncle wen you see dis. Dem kidnap Najeebah, her sisters plus dia papa for dia house last night. We don lose one,” she write.

Jaguda pipo also kidnap di family of one Nigerian lawyer, Oladosu Folorunsho wey dey work for Abuja.

A colleague of di lawyer post on X how kidnappers attack di Oladosu Ariyo for dia house for Sagwari Layout Estate for Dutse, Abuja and kidnap im wife wey also be lawyer and dia four children.

E say di incident happun on Sunday, 7 January 2024, around 7:30pm. “A band of kidnappers wey dress for full military camon invade my home and kidnap my wide and our four children.”

Oga Ariyo say di kidnappers bin call and dem demand for N60million ransom, im family and friends bin try raise N7million wey dem no gree collect,

“As at today, dem don kill my first born – Michelle Ariyo (aged 13) and dem dump her corpse on Kaduna road while dem dey threaten to kill my three remaining children (wey still be minors) and wife wey still dey for captivity.” E write.

Dem also don begin crowdfunding to raise money for dia release.

Nigerians for social media don also tok about oda kidnap cases wey don happun for dis year, however, BBC Pidgin neva confam dis tori.

Di tok tok person of di FCT Police, Josephine Adeh, say she no go fit tok about di mata “for security reasons”.

President Bola Tinubu, IGP, FCT Minister react

Inside all di security wahala President Bola Tinubu assure Nigerians say im administration go stamp out wetin remain of Boko Haram, Ansaru, banditry and kidnapping gangs.

Na for one book presentation on di administration of former President Muhammadu Buhari, e tok sake of kidnapping incidents wey don dey spread across di kontri, especially for Abuja, di kontri capital for di beginning of di year 2024.

“President Buhari assume office at a very difficult period of our national life wen di economy dey turn into recession and Boko Haram bin don take ova some parts of di North-east.

President Tinubu add say di job of securing every inch of di konti neva finish but im administration no go rest until dem completely uproot every agent of darkness.

Di Inspector General of Police for one meeting on Tuesday wit di Force Management Team and Tactical Squads for Abuja, order di Deputy Inspector-General of Police, Department of Operations, to personally coordinate high security strategies to destroy kidnappers plus oda criminally minded individuals for di FCT.

E e also don order dem to immediately bring di security situation back to normal.

Di Force tok-tok pesin Muyiwa Adejobi tok inside one statement.

Oga IGP also direct tactical squads to intensify efforts on di deployment of proactive measures to prevent criminal activities and protect citizens.

Source