AstraZeneca vaccine: Latest update about Nigeria vaccination programme and important tins to know

Vaccination

Reuters

Frontline healthcare workers for Nigeria don become di first set of pipo to collect di Oxford-AstraZeneca vaccine.

Oga of National Primary Health Care Development Agency Dr Faisal Shuaib, na im open di vaccination programme as im inject di vaccine to Dr Cyprian Nyong wey be di first pesin to receive di jab for Nigeria.

Dr Shuaib wey comot di details of di vaccination plan say frontline health workers na di pipo wey don dey do work pass since di epidemic break and dem need di protection in order to continue.

150 health workers go also receive di Oxford-AstraZeneca vaccine wey Minister of Health, Dr Osagie Ehanire tok say Nigeria drug agency NAFDAC don approve.

Dis mean say, unlike how oda kontri leaders do, Nigeria president Muhammadu Buhari no go be di first pesin to collect di vaccine wey land on Tuesday. Instead, President Buhari and im vice, Yemi Osinbajo go take di vaccine a day after on live TV.

Ghana president Nana Akufo-Addo no waste time to collect live on television, one day after di kontri vaccines arrive from COVAX.

Di National Hospital for di capital city Abuja go serve as di venue wia di frontline health workers dey vaccinated. Di launch ceremony go happun by 10am on Friday.

Oga Buhari and top goment officials own go follow on Saturday 6 March live for public.

“We dey hope say when Nigerians leaders see leaders see oga president and di vice president take di vaccine, e go give dem confidence say di vaccine dey safe,” Dr Shuaib bin tok.

Important tins about Nigeria vaccination programme

  • Official programme launch na on 5 March for frontline health workers; di next day di kontri leaders go collect
  • Next na vaccination for state level and state governors go dey encouraged to collect di vaccine live to give residents confidence say e safe. Dis go happun on 12 March
  • States wey never meet di requirements, like security for dia vaccine cold storage room, no go get any vaccine dose
  • Everybody wey wan collect di vaccine must fill form. Dis go determine di wia and when di injection
Africa vaccination map

BBC

How di priority of pipo go happen?

  • First phase – Frontline healthcare workers, then after regular healthcare workers, first responders, etc
  • Second phase – Old pipo because of dia weak immune system
  • Third phase – Pipo wey get underlying disease
  • Other pipo wey no get underlying disease or dey old. Dem need to dey 18 and above. Nobody under di age go collect di vaccine.

Dr Shuaib also say na only WHO approved vaccine and NAFDAC certified vaccines na im Nigeria go use only.