Israel-Hamas war, Turkey earthquake, Hilda Baci record – 13 events wey shake 2023

As 2023 dey come to an end, we say make we look back to some events wey shake di world.

From several devastating earthquakes, coups for Africa, conflicts for Israel and Gaza, di coronation ceremony of King Charles III, to Nigeria general elections, dis na some of di major events wey shape 2023.

Turkey and Syria Earthquake

Fotos of di earthquake destruction

Reuters

Ova 67,000 pipo die afta one powerful earthquake hit some parts of Turkey and neighbouring Syria for early mor-mor of 6 February as pipo still dey sleep.

Thousands of building collapse, plenty residents bin dey trapped under di rubble.

Most of di damages wey happun na sake of di 7.8 magnitude strike wey strike for Southern Turkey near di border of Syria and di 7.5 magnitude quake wey follow am.

E dey estimated to be di largest earthquake for Turkey since 1939.

One former Newcastle United and Ghana midfielder, Christian Atsu dey among those wey lost dia life for di earthquakes.

Morocco earthquake

Relatives dey mourn in front of di bodies of victims wey die for di earthquake for Moulay Brahim, for al-Haouz province

Getty Images
Relatives mourn in front of di bodies of victims wey die for di earthquake for Moulay Brahim, for al-Haouz province

On 8 September 2023, one powerful earthquake of magnitude 6.8 bin strike for Morocco at 18.5 km depth around 10:00pm.

Di quake epicentre na for remote area of di High Atlas Mountains, south-west of Marrakesh wey dey relatively shallow – and dem also feel tremors for di capital Rabat, and for Casablanca and Essaouira.

Several houses bin collapse and plenty buildings destroy.

According to national authorities, 2,946 pipo die sake of di quake and pipo wey injure pass 5,000.

Di World Health Organization (WHO) tok say more dan 300,000 pipo dey affected by di earthquake.

India overtake China as di world most populous kontri

Faces of pipo

Getty Images

For 2023, India bin overtake China to become di world most populous kontri.

According to di United Nations, India now get a population of 1.43 billion pipo wey pass dat of China for di first time.

Projections suggest say India go likely maintain dis status as di most populous kontri for many years to come.

Titan Submersible accident

Handout of foto wey OceanGate release of dia submersible vessel dem name Titan

PA Media
Handout of foto wey OceanGate release of dia submersible vessel dem name Titan

On 18 June, 2023, di search for one tourist Titan submarine wey carry pipo go see di Titanic ship wey sink many years ago bin spark international hunt and grip di attention of di whole world.

Di submarine wey get five pipo on board bin disappear for international waters for di North Atlantic Ocean.

Pipo begin dey panic afta no communication wit di submersible for about one hour and 45 minutes afta e dive enta water.

Four days later, afta plenty searching, dem find wetin remain of di Titan sub for about 1,600 feet (500 meters) from di Titanic.

All di pipo wey dey on board, wey include Oceangate CEO Stockton Rush, British billionaire explorer, Hamish Harding, French diver, Paul-Henry Nargeolet and one British businessman and im son wey come from one of Pakistan richest family die afta di submarine implode.

Nigeria 2023 election

Nigeria presidential candidates during di general elections

BBC

For February, millions of Nigerians bin vote for di most competitive presidential election since military rule end.

Dem also vote to elect lawmakers into di national assembly and di house of representatives. Governorship elections also hold for March.

Since 1999, di Africa most populous kontri bin dey dominated by two political parties – di ruling All Progressives Congress, APC and di Peoples Democratic Party, PDP.

But dis time, one strong challenger, di Labour Party wey get di support of many young pipo show for di election as a third force.

For di first time, di election see huge interest from first time voters and young pipo wey make di election dey of interest to pipo all ova di world.

Hilda Baci GWR win

Nigerian chef, Hilda Bassey Effiong, wey pipo sabi well-well as Hilda Baci bin break di Guinness World Record for longest cooking marathon by an individual.

Hilda Baci become national sensation afta she cook for 100 hours for May.

Her record attempt take di world of social media by storm, as millions of Nigerians and pipo all ova di world bin dey follow her progress via Instagram live stream.

Guinness World Record tok say her cook-a-thon bin dey so popular sotey dia website crash for two days sake of di plenty volume of traffic dem get from her legion of loyal fans.

Several high-profile Nigerian figures bin support her during her record attempt, like di Vice President of Nigeria, Professor Yemi Osinbajo; Governor of Lagos State, Babajide Olusola Sanwo-Olu; award-winning singer Tiwa Savage and many odas.

Niger Coup

Mohamed Bazoum

AFP
Mohamed Bazoum don dey under house arrest since di junta overthrow am for July

Sojas for di West African kontri of Niger bin say announce on nation TV on 26 July say dem don remove Niger President Mohamed Bazoum from office by one military coup.

Dat go make am di fifth coup for Niger since di kontri gain independence from France infor 1960.

Many world leaders, institutions and political bodies bin condemn di coup.

Regional organisation Ecowas bin threaten to use force re-instate Niger elected president but dem say dat kain move go dey more disastrous and destabilizing as dem dare di bloc.

Gabon coup

Yet anoda coup for Africa – just five weeks afta sojas of Niger President Mohamed Bazoum presidential guard take am hostage, Gabon President Ali Bongo also see imself for similar situation as e dey under arrest for im own house.

On August 30, just hours afta Gabon election commission announce say President Ali Bongo Ondimba don dey elected for third term, one group of Gabonese military officers from di elite presidential guard unit bin take ova power and put di president under arrest for im palace.

Oga Bongo overthrow end im family 55-year hold on power for Gabon.

Sudan conflict

Black smoke in Khartoum

Getty Images
Fresh explosions bin breakout for Khartoum

Sudan dey on di brink of collapse as forces wey dey loyal to two rival generals dey battle for control of di resource-rich North African nation.

Di ongoing conflict don lead to di death of hundreds of pipo, thousands dey injured and hundreds of thousands dey displaced, according to figures from di United Nations.

More dan one million pipo don run comot Sudan go neighbouring kontris since April, according to di United Nations, as fighting between two warring factions continue to dey drag to civil war.

Coronation of King Charles

Dem officially crown King Charles III and im wife, Queen Camilla, for inside one historic ceremony for London Westminster Abbey on 6, May.

King Charles become di 40th reigning monarch dem go crown dia since 1066. Dem also crown Queen Camilla.

Di coronation ceremony, show centuries of tradition but dem also spice am up small for di modern age in front of about 2,000 invited guests plus global audience of millions wey watch am on TV or livestream.

Although King Charles officially become king afta di death of im mother, Queen Elizabeth II, on 8 Sept, 2022, di coronation ceremony consecrate and celebrate im ascension to di throne.

Nigerian singer Tiwa Savage dey among di ogbonge musicians all ova di world wey perform for di Coronation concert.

Israel – Gaza war

One Palestinian boy react in front of one burning Israeli car wey militants seize

Reuters
One Palestinian boy react in front of one burning Israeli car wey militants seize

On 7 October, hundreds of Hamas gunmen bin cross from di Gaza Strip enta southern Israel, dem break through heavily guarded perimeter fence to enta di kontri and carry out one attack wey dem attempt before for di kontri.

Di attack na di most serious cross-border attack against Israel for more dan one generation.

Di gunmen kill about 1,200 pipo, most of dem civilians for military posts, kibbutzim plus for one music festival, and dem take hostages go back Gaza.

Di Israeli military respond wit air strikes on Gaza, dem also launch ground offensive.

More dan 20,000 pippo don die for Gaza, according to di Hamas-run government.

Twitter name Change to X

Elon Musk and X logo

Getty Images

Twitter famous blue bird bin die on 23 July wen tech billionaire Elon Musk decide to rebrand di social media giant name to X.

Social media bin scata afta Elon Musk wey buy Twitter for 2022 announce di change of name for di app.

For July 2023, Musk begin call Twitter X and change di logo on phones, websites plus Twitter accounts.

Global temperatures shatter records

One pesin dey cool off for di Piazza del Popolo for Rome, Italy, on 18 July 2023

Reuters

2023 na possibly di hottest year on record. Global temperatures neva dey dis high in 125,000 years.

Di world average temperature bin reach new record for July.

Data wey one group of US scientists analyse show say di global average temperature pass 17.23C.

Di World Meteorological Organization bin warn of serious heatwave for Europe, Southern US and across di world.

Millions around di world bin dey under heat advisories as officials warn of danger to life from di hot temperatures.

Scientists say climate change dey make heatwaves longer, more intense and more frequent.

Source