
Nigeria beat Guinea Bissau 1-0 for di reverse leg of dia African Cup on nations qualifying match on Monday evening.
Moses Simon score from penalty kick to give di Super Eagles victory for Estadio 24 De Setembro, Bissau..
Di Super Eagles bin dey under pressure to win di game afta dia shock defeat on Friday.
Nigeria coach, José Peseiro make some changes to im starting line-up for di game.
E drop Wilfried Ndidi and Kelechi Iheanacho and di changes pay off.
Dia performance improve from dia last game wey dem play for Mooshood Abiola stadium Abuja.
Dis result mean say Nigeria get nine points and dey top group A while Guinea Bissau get seven.
Super Eagles next match na away to Sierra Leone on June 12.
Dia final qualifying match na at home to Sao Tome and Principe for September 4.
Checkout di match highlights here.
Second half
90′ + 5 mins- Full time! Guinea-Bissau 0 -1 Nigeria
90′ + 5 mins- Ahmed Musa don win free kick for di defensive half na Dálcio foul am.
90′ + 4 mins- Substitution! Nigeria. Ahmed Musa don replace Moses Simon.
90′ + 4′ mins- Missed attempt! Victor Osimhen right foot shot from difficult angle for di right just miss target na Alex Iwobi give am di pass.
90′ + 2′ mins- Francis Uzoho chop yellow card.
90′ + 2′ mins- Offside! Guinea-Bissau. Opa Sanganté play through ball, but Piqueti dey offside
90 mins- Last minute before added time na still Guinea Bissau 0-1 Nigeria
85 mins- Nigeria dey do eviritin to protect dia lead
80 mins- Moses Simon goal be di difference between di two teams
75 mins- Hand ball by Frank Onyeka.
75 mins- Blocked attempt! Dálcio left footed shot from outside di box dey blocked.
74 mins- Mama Baldé don win free kick from im defensive half.
73 mins- Missed attempt! Victor Osimhen right foot shot from difficult angle on di right miss to di left.
72 mins- Missed attempt! Alex Iwobi right foot shot from outside di box.
71 mins- Corner kick, Nigeria.
71 mins- Saved attempt! Joe Aribo left foot shot from di left side of di box dey saved for ditop left corner na Moses Simon give am di pass.
70 mins- Offside, Nigeria. Zaidu Sanusi play through pass, but Joe Aribo dey offside.
69 mins- Substitution, Guinea-Bissau. Piqueti don replace Jorginho.
67 mins- Missed attempt! Mama Baldé right foot shot from di left side of di box dey high and wide to the right.
66 mins- Corner kick, for Guinea-Bissau.
64 mins- Hand ball by Fali Candé
63 mins- Missed attempt! Victor Osimhen right foot shot from centre of di box dey close
62 mins- Saved attempt! Dálcio left foot shot from di left side of the box but keeper save am.
61 mins- Substitution, Nigeria. Joe Aribo don replace Terem Moffi.
60 mins- Missed attempt! Terem Moffi header from centre of di box dey miss target
60 mins- Zaidu Sanusi wins free kick for left wing.
59 mins- Victor hit di left post from im right foot shot from di centre of di box.
58 mins- Moreto Cassamá don winfree kick for di attacking half na Frank Onyeka foul am .
56 mins- Terem Moffi don win free kick for di right wing.
55 mins- Samuel Chukwueze don win free kick for di defensive half na Burá foul am .
55 mins- Jonas Mendes don win free kick for di defensive half afta Terem Moffi touch di ball
54 mins- Corner kick, Nigeria.
53 mins- Burá don win free kick for di attacking half na Frank Onyeka foul am .
53 mins- Game don start again.
52 mins- Small delay for di match sake of injury to Bright Osayi-Samuel.
51 mins- Corner kick, for Nigeria.
50 mins- Foul by Alfa Semedo,Frank Onyeka don win free kick for di attacking half.
47 mins- Missed attempt! Nanú left footed shot from outside di box dey too high na Moreto Cassamá give am di pass.
46 mins- Sori Mané don win free kick for inside im half na Victor Osimhen foul am .
Game don start oh
Second half go soon start for
First half
45′ + 2 mins- First Half don end, Guinea-Bissau 0 – 1 Nigeria
42 mins- Missed attempt! Jorginho right foot shot from centre of di box dey too high.
42 mins- Offside! Nigeria. Terem Moffi through pass, but Victor Osimhen dey offside.
41 mins- Saved attempt! Semi Ajayi header from centre of di box goalkeeper save am.
37 mins- Missed attempt! Samuel Chukwueze left foot shot from di centre of di box dey too high.
36 mins- Kenneth Omeruo don chop yellow card for bad foul.
36 mins- Mama Baldé don win free kick for im team na Kenneth Omeruo foul am .
33 mins- Offside! Nigeria. Alex Iwobi through pass, but Victor Osimhen dey offside.
32 mins Offside! Guinea-Bissau. Jonas Mendes play through ball, but Jorginho dey offside.
30 mins- Goal! Guinea-Bissau 0, Nigeria 1. Moses Simon (Nigeria) score from penalty kick.
29 mins- Penalty to Nigeria, Fali Candé foul Bright Osayi-Samuel inside di box.
28 mins- Fali Candé wins free kick for im team afta Victor Osimhen foul am
26 mins-Anoda missed attempt Alex Iwobi shoot shot from outside the box.
23 mins- Missed attempt! Victor Osimhen right foot shot from di centre of di box miss di goal na Samuel Chukwueze give am di pass.
19 min- Nigeria get corner kick
15 mins- Burá win free kick for im team afta Frank Onyeka foul
13 mins- Offside! Nigeria. Semi Ajayi through ball, but Victor Osimhen dey offside.
11 mins- Fali Candé wins free kick for inside im half na Semi Ajayi foul am
10 mins- Frank Onyeka win free kick for di left wing.
9 mins-Missed attempt missed. Zaidu Sanusi shot from outside di box dey too high from dia corner kick.
6 mins- Missed attemppt. from Alfa Semedo of (Guinea-Bissau) im shot from outside di box.
3 mins- Corner for Nigeria.
2 mins- Attempt saved. Kenneth Omeruo header from centre of di box dey saved na Alex Iwobi cross di ball.
1 min- Attempt blocked. Moses Simon right foot shot from di left side of di box dey blocked.
1 min – Match don start for di Estádio 24 de Setembro
Game go soo start
Guinea Bissau vs Nigeria line up
Nigeria XI: Francis Uzoho; Semi Ajayi, Kenneth Omeruo, Bright Osayi-Samuel, Zaidu Sanusi; Alex Iwobi, Frank Onyeka; Moses Simon, Terem Moffi, Samuel Chukwueze, Victor Osimhen.
Guinea Bissau vs Nigeria build up
Dis na di di third meeting between di two kontries since 2022.
Di first time dem meet na for di 2021 Afcon finals for Cameroon, Super Eagles win 2-0 win.
Nigeria coach, José Peseiro neva win in last four games in all competition.
Currently, na Guinea Bissau dey lead Group A wit seven points, one point more than Super Eagles.
Meanwhile Sierra Leone get five points afta dem win against Sao Tome & Principe on Sunday.