Supreme Court fix date for judgement on naira redesign

Getty

Getty Images

Di Supreme Court don fix 3 March to give judgement for di naira redesign case.

Di court fix di date afta hearing and taking di reliefs of parties in di case.

Na Kaduna, Zamfara and Kogi States first file di case for court.

At di resumed hearing on Wednesday all di plaintiffs for di naira redesign matter dey pray di court to dismiss all preliminary objections and grant reliefs of dia originating summons.

Dem also pray di court to deny di defendants sake of say dem disobey court order.

Lawyer wey dey represent Zamfara state A. J. Owonikoko, SAN wey dey represent Zamfara state say dem don file application to set aside di president Muhammadu Buhari directive on 16th February, a day afta di court sit.

“I dey adopt all di briefs wey I file. I dey also adopt di position of my colleague wey dey appear for Kaduna and Kogi, and set aside di directive of di President limiting exchange to only di old #200.

For dia response di federal goment Lawyer Kanu Agabi SAN say dia processes don cover all di issues and dem dey request for all di the cases to be dismissed.

E say if di court hold all di reliefs of di originating summons wey dey inside di CBN Act, di Supreme Court no get jurisdiction to hear di mata.

“If court discover say we dey right under Section 23 of di CBN Act, di defendants dey cry in di wrong place den cases should be dismissed.

“Dem make references to di CBN 32 times for dia originating summons, yet dem no join di CBN for di matter.

“Long bifor you make your order pipo don dey reject di old notes already including dis court.

“Di President only act to save di nation from drifting,” e tok.

Audu Anuga SAN, wey dey represent Bayelsa support oga Agabi and oppose all di plaintiffs and dia requests.

Counsel to Edo State goment Kenneth Mozea SAN also agree wit oga Kanu Agabi.

Parties tok wetin di adjournment mean

Attorney General of Lagos Moyo Onibanjo afta di hearing tell tori pipo say “pending di judgement of di court di interim order still dey in place, wey mean say di old N 1,000 and N500 notes still be legal tender”

Im add say Lagos na one of di states wey di policy dey affect well-well in terms of revenue wey dem dey collect and if e kontinu like dis e go affect di pipo well well wey fit lead to more violence for di state.

On im part Kanu Agabi wey dey represent Federal goment tell tori pipo say “di president get great respect for di court, di president go do nothing to undermine di powers and jurisdiction of di court, all of us dey work hard to try to salvage a difficult situation, na one nation and one pipo, we dey find solutions.

Pipo wey get di Naira for dia hands make dem submit am to di CBN or designated banks, e add.

Oga Agabi say “nobody go lose dia money if dem try to comply. No two parties dey dis mata, na only one party wey be di nation and we dey try to solve dis mata”

Di mata for Supreme court so far dey go?

Last week Wednesday di seven-man panel of judges wey Justice John Okoro dey lead say dem go hear di consolidated suits wey govnors of nine states file.

Wen im dey address di court, im give assurance say di court no go lose sight of di case and im intention as e affect di suffering of Nigerians.

Last week, court full wit Senior Advocates of Nigeria, sotay some pipo no see chair siddon.

Govnor Yahaya Bello of Kogi state, and im counterpart for Kaduna state, Nasir El-Rufai bin also show face for court for di hearing .

For di last hearing, di Court bin temporarily suspend di implementation of di 10 February 10 deadline of di CBN from making di old N200, N500 and N1,000 notes legal tender.

Counsel to di plaintifs, Abdulhakeem Mustapha say both currencies still remain legal tender for di kontri and if CBN do oda wise, e go mean say dem dey go against di Supreme Court.

Na Zamfara, Kogi and Kaduna states bin sama di suit against di Federal Government and di CBN.

For di hearing on Wednesday, six oda states including Lagos, Ekiti, Osun, Katsina, Ondo, Cross Rivers – join di plaintiffs while Bayelsa and Edo state join to support di federal goment and CBN as respondents.

Supreme court go overturn President Buhari order?

One day afta di Supreme Court adjourn di hearing of di suit, Nigerian President Muhammadu Buhari for im brodcast on 16 February 2023, direct di CBN to release di old notes of 200 naira for Nigerians to kontinu to use am as legal tender.

Di president tok say di 200 naira go function as legal tender alongside new 200, 500 and 1000 naira notes.

”To further ease di supply pressures particularly to our citizens, I don give approval to di CBN say make dem release di old N200 bank notes back into circulation and make dem allow am circulate as legal tender wit di new N200, N500, and N1000 banknotes for 60 days from February 10, 2023 to April 10 2023 wen di old N200 notes cease to be legal tender”.

Wetin dis one mean be say di old 500 and 1,000 naira no longer dey valid as legal tenders.

Di President say di CBN go kontinu to collect di old 500 and 1000 notes in line wit Section 20 (3) of di CBN Act 2007.

E say im find am necessary to address im kontri pipo as im kontinu to sustain di fight against insecurity.

Di President also express im sympathy sake of di difficulty Nigerians dey experience ova di naira redesign policy of di CBN.

But as President Buhari give dis directive, some states like Kaduna so dem go continue to use di old notes until court hear and rule on di mata.

Some lawyers don drag President Buhri say im directive go against di Supreme court.

Wetin scarcity of cash dey cause

Nigerians belle no dey sweet dem at all sake of di new CBN policy wey don make cash scarce well.

Di policy cause kata-kata for many parts of di kontri as some banks dey hide di new naira notes and customers no see both new and old naira notes collect for counter and ATMs.

Dis scarcity don make customers para well well sotay dem use vex begin attack banks and stage protests for some parts of di kontri.

For Warri, Delta State, one video show wia bank customers dey escape through di back fence sake of angry customers wey no see cash collect.

Oda videos show some bank customers dey naked diasef to protest sake of say dem no see moni collect for bank.

Oda videos show ATMs wey angry customers destroy for Abeokuta Ogun state sake of dia lack of access to cash.

Nigerians dey find am difficult to access cash and some photos wey don go viral even show di old N200 notes wey banks don dey recirculate no no dey in good shape

Evribody dey wait for di Supreme Court ruling to hear wetin di seven man panel go tok.