Wike reply tori say e wan be Atiku vice president

2019 PDP Presidential candidate Atiku Abubakar and Rivers state govnor Nyesom Wike

BBC

Rivers state govnor Nyesom Wike say tori about im to be vice presidential candidate to Atiku Abubakar no be true.

Oga Wike make di clarification during im meeting wit some Peoples’ Democratic Party (PDP) leaders for Goment House Port Harcourt.

E say di viral media report no make sense – “If I wan run election, I go run and nobody fit stop me,” e tok.

Tori come out on Monday say PDP Presidential candidate for 2019 Atiku Abubakar ignore Peter Obi and odas to pick Nyesom Wike as im running mate.

But Wike say na lie.

No be di Atiku Abubakar presidential campaign make di statement but Wike also blame di group for dia statements during dia statewide consultation.

Di govnor also say e dey disappointed about how technical committee of Atiku Abubakar presidential campaign dey tok about how di party suppose zone di PDP presidential ticket

South go decide and e go ‘choke’

Govnor Wike say na di Southern caucus of di opposition party go decide on wetin dem go do ahead of di 2023 presidential election.

“Abeg make evri bodi ignore those tins una dey hear say I wan be VP to dis and dat. All dat na social media some tin. Make una ignore am.

“But make I tell una say di south go make statement very soon. Make everi body relax and allow di South do dia proper home work.

“Di day di south go make statement, pipo go know say we no dey joke. Wen di South go tok, e go choke dem,” Wike tok