Mechanic for Nasarawa wey gunmen attack and cut im two hands tok how e hapun

Yahaya Muhammed Galadima

BBC

‘I dey come back around 8:00pm wen five men stop me come begin dey hit me wit big stick. One of di gunmen approach me come begin hit me wit cutlass, na as I use my hand tke block my head dem cut am.’

25-year-old mechanic, Yahaya Muhammed Galadima, wey gunmen attack and cut off im two hands for Nasarawa state north central Nigeria narrate di terrible incident wey lead to di loss of im hands.

Galadima dey in shock say im no go ever fit use im hand for di rest of im life again.

Gunmen attack Galadima on Friday, 28 January as e dey come back from Yelwa village for Doma Local goment area, wia e bin go repair one J5 bus wey break down for road.

Galadima wey dey cry as e narrate im ordeal to BBC Pidgin, say im bin dey come back around 8:00pm to Lafia di state capital wen five men stop am for di village, come hit am wit big stick.

One of di gunmen come approach am begin hit-hit am wit cutlass.

E come use im hand to block im head so dat di cutlass no go cut im head, na for dat process dem cut im hand.

Galadima dey receive treatment for Dalhatu Araf Specialist Hospital, Lafia for Nasarawa state.

Yahaya Muhammed Galadima

BBC
Yahaya Galadima dey receive treatment for Dalhatu Araf Specialist Hospital for Lafia, Nasarawa state afta gunmen attack am wen e dey return from outside work for Rukubi for Doma local goment.

‘Dem collect evrytin plus my hands’

Wen di gunmen attack Galadima for road and bea am, e fall for ground.

Di jaguda boys come ask am to give dem im Okada, moni and phone, and e give dem everitin.

Galadima say e shock wen one of di gunmen come begin cut-cut am wit cutlass.

Afta dem finish, dem come run leave am for ground in pains.

E say na im 13-year-old apprentice wey dey wit am come begin scream for epp and passers-by come stop epp dem.

E say dem take dem go Doma and from dia, dem come cari dem go Dalhatu Araf Specialist Hospital for Lafia wia e dey collect treatment.

Galadima say im feel very terrible about wetin happun to am and dat im dey worry say im no go fit use im hand for di rest of im life again.

“I no fit believe sayI no get hand again” e tok.

Galadima and im mama for hospital

BBC
Galadima and im mama for hospital

‘My world don end’

Galadima dey full of regret – e say if to say im know say im no go return home wit im two hands, im for no go far go repair im customer motor again.

“If I know…if I know…(e cry)…Look I no fit use my hands again” e cry as e point im hand up.

E say e hope say God go epp am learn new skill to be able to survive and feed im family.

Galadima come from Kilema for Lafia, di state capital.

E don be mechanic for 20 years now – e bin start as motorcycle mechanic before e come upgrade to repair J5 buses.

Galadima get wife and three pikin, di twins be three years and di latest pikin na 6 months.

E say im dey make close to five to ten thousand naira everyday and na di moni e dey take cater for im family and im mama.

Di auto mechanic say as e be now wey im no get hand, e go dey difficult for am to kontinu wit im mechanic work and dat im dey find am very difficult to cope and dat im no know how to work and take care of im family again.

“Mechanic work need energy, now wey I no get hand again, how I go fit work” Galadima explain as e cry.

Galadima mama, Ramatu Adamu dey heartbroken as she tok to BBC pidgin on top di pain wey im pikin dey go through.

She say she dey bad and her world don end sake of say she now dey take care of am like pikin.

She say na she dey bath am, feed am and cari am go toilet.