Senegal Vs Zimbabwe Afcon 2021: Last minute penalty give Teranga Lions victory

Two Zimbabwe players mark MANE

Getty Images

Senegal win Zimbabwe 1-0 on penalty for dia first game for Afcon 2021 inside seven minutes stoppage time as both sides open Group B for Bafoussam.

Sadio Mane score for inside extra time to give im team di lead afta Kelvin Madzongwe (Zimbabwe) concede penalty with hand ball for di penalty area for inside di last minute of extra time.

Senegal bin miss plenti chances.

Di best of dem na midfielder Gana Gueye own just before before half-time but di Paris Saint-Germain star no fit control easy pass from Mane with di goal wey dey in reach.

Mane miss chance for di half wen e shoot straight give Zimbabwe goalkeeper Petros Mhari wey stop am.

Senegal come into dis tournament with aim to get first Nations Cup crown afta losing di 2019 final to Algeria but dem dey far from dia best afta only being able to name 17 players, out of a squad of 28, sake of Covid cases and injuries.

Di West Africans start di lunchtime kick-off well, with Bayern Munich Bouna Sarr wey strike a low shot just inches wide before Keita Balde also fail to hit di target wen e get di ball.

for di oda end, Knowledge Musona let fly from 20 yards only to see im fine strike go past di post as Zimbabwe, wey dey look to reach di knock-out stages for di first time, go close.

Shortly after half-time, Pape Cisse spurned a glorious chance to break the deadlock but could only steer his free header from a corner powerfully past the post with Mhari stranded.

Las-las, Senegal – Africa top-ranked side for di last three years – fail to impress against a well-organised Zimbabwe side.

Senegal bin dey without goalkeeper Edouard Mendy and defender Kalidou Koulibaly for dia opening game afta both players test positive for coronavirus.

Di Teranga Lions wey be runners-up for di 2019 edition of di tournament dey face Zimbabwe for for di Bafoussam Omnisport Staduim Kouekong.

Chelsea keeper Mendy, centre-back Koulibaly and striker Famara Diedhiou don all go into isolation.

Line- Up

Senegal

Formation 4-3-3

1 Dieng

21 Mbaye

4 Cissé

22 Diallo

12 Ballo-Touré

20 Sarr

8 Kouyaté

5 Gueye

9 Dia

10 Mané

7 Keita

1 Dieng

21 Mbaye

4 Cissé

22 Diallo

12 Ballo-Touré

20 Sarr

8 Kouyaté

5 Gueye

9 Dia

10 Mané

7 Keita (E collect Yellow Card for 31mins)

Substitutes

11 Diallo

13 Lopy

24 Name

25 Loum

26 Gueye

28F aty

Zimbabwe

Formation 4-1-4-1

1 Mhari

22 Chimwemwe

5 Takwara

15 Hadebe

14 Bhasera

4 Madzongwe

7 Wadi

17 Musona

8 Benyu

12 Kangwa

18 Dube

1 Mhari

22 Chimwemwe

5 Takwara

15 Hadebe

14 Bhasera

4 Madzongwe

7 Wadi

17 Musona

8 Benyu

12 Kangwa

18 Dube

Substitutes

2 Murwira

6 Mudimu

9 Moyo

10 Kadewere

11 Tigere

13 Kamusoko

16 Mahachi

19 Muskwe

20 Muduhwa

21 Shumba

23 Mapisa

Referee:

Mario Escobar