Airlines wey go bring travellers wey no vaccinate into Ghana go pay fine of $3,500 per passenger.
In addition to dis new guideline, airlines wey go fly passengers wey no get PCR test or passengers with positive PCR test results into Accra go pay $3,500.
Dis be part of efforts Ghana put to manage de importation of COVID-19 cases, especially de Omicron variant which detect some 41 cases.
According to de Ghana Airport Company Limited, all arriving passengers for carry COVID-19 negative PCR test from accredited laboratory in dema country of origin.
Dem add say de test for be not more than 72 hours before de planned departure time from de country of origin.
According to GACL, dem go return passengers wey no vaccinate or get negative PCR test results back to de country dem travel from.
Meanwhile, Ghanaians who go come without negative PCR test or vaccination go-go through 14 day quarantine dem mandatory vaccination for Accra.
Meanwhile, Ghana Health Service early last week introduce new COVID-19 protocols for international travellers who dey enter de country through Kotoka International Airport (KIA).
De new travel guidelines dey for statement wey Patrick Kumah Aboagye, de Director General Ghana Health Service sign.
According to Dr Aboagye statement, dis be necessary sake of de recent Omicron virus wey dem discover in de country.
“Over de last two weeks, cases from de airport alone dey account for about 60% of de total cases recorded in de country,” he explain.
Apart from that, de recent rise in imported COVID-19 cases for de airport be major reason to intensify efforts for there.
According to de statement, “Globally, chaw countries dey experience fourth wave. Some travelers from dis countries go come Ghana during de festive season.”
“Dis current surge in COVID-19 cases dey show for Kotoka International Airport (KIA).
Guidelines for travellers to Ghana
Dis be de new guidelines Ghana Health Service dey introduce for all travellers who dey enter de country.
1. All pesins 18 years and above who dey arrive for Ghana for provide evidence of full vaccination for COVID-19 vaccine.
2. All unvaccinated Ghanaians and residents of Ghana who currently dey outside de country den plan to intend to return within 14 days from de midnight of 12th December 2021 be exempted.
However, dem go receive vaccination on arrival for de airport.
Travelling Out of Ghana
All Ghanaians who dey travel outside de country for ensure say dem be fully vaccinated from midnight of 12th December 2021.
Who be fully vaccinated?
Ghana Health Service dey consider person as fully vaccinated once den receive full dose of vaccines wey Food and Drugs Authority approve.
One dose for Johnson and Johnson den two doses for other vaccines like Moderna, Sputnik K, Pfizer den AstraZeneca.