Fifa Disciplinary Committee don sanction di President of di Cameroonian Football Association (Fecafoot).
Fifa Disciplinary Committee sama Samuel Eto’o wey be di President of Fecafoot six months ban.
E mean say e no go fit attend matches wey any representative from Cameroon dey play.
According to Fifa, Eto’o chop di ban sake of breaches of article 13 wey be offensive behavior and violations of principles of fair play.
Im also breach article 14 wey concern misconduct of players and officials of di Fifa disciplinary code.
Fifa sama Eto’o di ban wey go start today 30 September, 2024 in connection with di Fifa U-20 Women’s World Cup.
- Eto’o and di kasala wey dey go on for Cameroonian football
- Samuel Eto’o plead guilty to £3.2m tax fraud
- Samuel Eto’o: Cameroon elect former football star president of di kontri football federation
Di 43-year-old no go fit go watch all football matches wey di involve di men and women representative sides from Cameroon, for all categories and age groups.
Cameroon men go face Kenya for di 2025 Africa Cup of Nations qualifier double- header for October.
Eto’o bin lead one meeting for Douala earlier on Monday to discuss preparations ahead of di visit of di Harambee Stars of Kenya on 11 October.
BBC don contact Fecafoot to chook mouth for di mata.
Di many colours of Eto’o time in office
Dis na di latest sanction wey dey hit Eto’o, wey di Confederation of African Football (Caf) bin sama fine of $200,000 forJuly for breach in ethics.
One disciplinary panel bin find out say di four-time African Footballer of di Year bin “seriously violate di principles of ethics, integrity and sportsmanship” of Caf wen im bin sign one contract to be an ambassador for betting company 1XBET.
Eto’o lawyers bin tok say dem go appeal against di verdict, wey bin come afta one Caf investigation find insufficient evidence to pursue a charge related to allegations of match-fixing.
Eto’o bin enjoy beta playing career wia im bin shine well-well both for Europe and wit Cameroon.
But controversy don surround am since dem elect am as Fecafoot president for 2021.
Last year one group wey dey represent amateur clubs for Cameroon tell di former Chelsea and Barcelona player to resign, as im mention “grave irregularities” (big mago-mago) for Fecafoot.
One former international team-mate bin also describe Eto’o as a “dictator” sake of di way im dey rule di organisation.
Eto’o bin dey involved for one long-running kasala wit di Ministry of Sport for di kontri over di naming of Marc Brys as coach of di Indomitable Lions early dis year bifor dem later accepting di appointment of di Belgian.