Abiola Ajimobi, Oyo State ex-Govnor and Senator don die – See wetin we sabi about im death & burial

Abiola Ajimobi, di former govnor of Oyo State south-west Nigeria die from multiple organs failure following complications from COVID19 infection.

Na wetin BBC Pidgin find out from heath authorities as e concern di cause of Ajimobi death wey die at di age of 70.

Na one close aide of di Senator and anoda family member first confam Ajimobi death to BBC on Thursday evening of 25 June.

Senator Abiola Ajimobi die for First Cardiologist Consultant; one private hospital inside Lagos, wey goment give approval to operate as Coronavirus COVID19 care facility, according to Professor Akin Abayomi, di Lagos State Commissioner for Heath.

Oda of im close friends don begin post sorry messages of im death. Nigeria President Muhammadu Buhari mourn di death of Ajimobi for statement from im office.

Otunba Adebayo Christopher Alao-Akala, di former Oyo govnor wey Abiola Abiola Ajimobi succeed tell BBC im dey in shock over di death of di man wey take over from him.

Oga Ajimobi dead mata land afta di former govnor spend weeks in coma inside intensive care for coronavirus complications, according to wetin Akin Alabi wey be federal lawmaker and political associate of di late senator tok.

Di family say dem go bury Ajimobi on Friday for Ibadan, di Oyo State Capital, BBC Pidgin find out.

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/256719265626783

Who be Abiola Ajimobi?

Dem born am as Isiaka Abiola Ajimobi on 16 December, 1949.

Na for im state of origin Oyo, im do im primary and secondary education.

Ajimobi travel go America for im university education wia im study Business Administration and Finance for State University of New York and later do MBA for State University, Illinois.

E marry Florence 1980 and dem get five children.

Im political career begin for 2003 when im bin serve as Deputy Minority leader for Senate. By 2007 im contest to be govnor of Oyo State but e no win am.

For 2011, e become govnor for di first time, and later e break record for Oyo to be di first pesin to do two democratic terms back-to-back for di state.

Around 18 June, rumours bin dey fly upandan say di lawmaker and former govnor don die, only for im daughter Fatima Ganduje-Ajimobi to comot for social media to deny am.

Inside interview with BBC Yoruba on Tuesday, 16, June , 2020, im tok-tok pesin Bolaji Tunji tok say ‘Ajimobi say im go settle all di wahala wey dey di political party during dia National Executive Council (NEC) meeting’.

Oga Tunji also bin deny all di rumours wey dey fly around say senator Ajimobi dey coma and dey receive treatment for hospital.