Manchester United don reach agreement with Shanghai Greenland Shenhua to extend di loan deal for Odion Ighalo.
Di Nigerian striker deal with United bin suppose end for 31 May but im go now remain with di Reds until 31 January 2021.
Dis na according to informate for Manchester United official club website.
- Ighalo leg dey shake for Manchester United, see oda players wey dey dis table
- “My mama cry wen she hear say Manchester United sign me” – Odion Ighalo
- Ighalo loan move to Manchester United ‘shock’ fans
Ighalo don score four goals for di eight games im don play for Manchester United.
Today confirmation na big boost for United manager Ole Gunnar Solskjaer, as im continue to dey prepare im squad for dis month resumption of competitive football.
United dey fifth for table, three points behind fourth-placed Chelsea with nine games to play.
Solskjaer side dey quarter-finals of FA Cup and dem get five-goal lead going into di second leg of dia Europa League last-16 tie against LASK.
Happy new month Fams😊❤️ pic.twitter.com/vfuy2CVYPR
— Odion Jude Ighalo (@ighalojude) June 1, 2020