Boko Haram: Governor Zulum lead burial for Borno farmers militants slaughter – See how di attack happun

Borno state Governor, Babagana Zulum na im lead kinsmen and odas wey still dey in shock go di burial of 43 farmers wey Suspected Boko Haram militant kill yesterday.

Governor Zulum tok during di burial say e dey very sad say dem slaughter dis farmer as dem dey work inside dia farmlands.

“Our pipo dey in very difficult situations, dem dey in two different extreme conditions, If dem stay for house, hunger fit kill dem, if dem go farm, dem fit die for jaguda pipo hand.”

“E dey sad and we dey ask di federal goment to employ more of our youths for di CJTF and hunters for di Nigerian military and di Civil Defence to protect our farmers.”

“We no go lose hope because we have to dey hopeful about ending di insurgency” Zulum tok.

Dem tell di Governor say investigation still dey go on to know di number of pipo wey die for di attack.

Meanwhile, Nigerian president, Muhammadu Buhari, don condemn wetin e call di senseless killing of more than forty farmers inside Borno State, North-East of di kontri.

President Buhari tok dis afta di attack wey happun for rice fields wey dey Zabarmari, inside Jere Local Government of Borno State- one region wey both Boko Haram and di Islamic State West Africa group dey active.

President Buhari tok say di whole of Nigeria dey shocked by di attack wey suspected Boko Haram Islamist militants carry out.

How di attack take happun

Rice farmers remove weeds on a rice field outside northern Nigerian city of Kano on July 4, 2017.

Getty Images

Local officials tok say di migrant labourers bin dey harvest rice wen di attack take place on Saturday.

Forty- three bodies na im dem don recover.

According to reports, di attackers tie up di agricultural workers and cut dia throats inside one rice-farming town near Maiduguri, di capital of Borno state.

Report also say di attackers kidnap six oda farm workers.

No group don come out yet to claim responsibility for dis attack.

BBC tori pesin report say Boko Haram don bin attack farmers before, on top say dem dey suspect say di farmers dey pass information give di military.

Last month, Boko Haram fighters kill 22 farmers wey dey work on irrigation fields for two separate incidents.