Ahmed Nuhu Bamalli: New emir of Zazzau biography & Nasir Ahmad el-Rufai, Kaduna Govnor announcement for Zazzau Emirate

Ahmad Nuhu Bamalli na di new emir of Zazzau, Kaduna Govnor Nasir El Rufai don announce.

Di govnor of Kaduna state for northern Nigeria Mallam Nasir Elrufai on Wednesday announce say immediate past Nigerian ambassador to Thailand Ahmad Nuhu Bamalli go be di new Emir of Zaria.

Bamalli go replace di late Shehu Idris wey die on 20th of September 2020 after 45 years on di throne.

New Emir Bamalli bin serve as commissioner for Kaduna state under El Rufai goment.

Alh. Bamalli na di first emir from di Mallawa ruling house in 100 years, following di death in 1920 of im grandfather, Emir Dan Sidi. According to Govnor El Rufai.

Di Kaduna govnor don congratulate HRH Alhaji Ahmed Nuhu Bamalli on im appointment and wish am a successful and peaceful reign.

HRH “Ahmed Nuhu Bamalli” – Wetin you need know about new Zaria Emir

Ahmed Nuhu Bamalli before im appointment as new Emir na di second most senior royal for Zaria Emirate Council based on im title wey be ‘Magajin Garin Zazzau’ wey mean Lord Mayor of Zaria and e also serve as Nigeria’s ambassador to Thailand from 2017 to 2020.

Ambassador Ahmed wey dem born in 1966 study law for Ahmadu Bello University for im first degree and international relations and diplomacy for im masters before e start im bank work and later foreign relations.

E don tey wey many dey tout di ‘Magajin Garin Zazzau’ as next Emir as many dey tell am ‘Sai Kayi’ (you will be (Emir) when dem see am. So for many dat chant don finally become reality.

Di new Emir also work with Nigeria Security Printing and Minting Corporation as Executive Director and mobile network company Mtel as Head of Human Resources before im role as ambassador.

He dey married to one wife Mairo Bamalli wey be im cousin and dem get five children together 4 boys and one girl.

(We still dey update dis tori, just refresh di page for latest update).