NAFDAC warn Nigerians not to chop organic apple and blackcurrant from Australia

Apples

Getty Images

National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC), di Nigeria office wey dey control food and drugs mata, don draw ear give Nigerians make dem no chop organic apple and blackcurrant wey dem import from Australia.

Di fruits dem dey harmful for pipo body sake of say e get high level of Patulin aka amycotoxin, oga kpata-kpata of NAFDAC, Prof. Moji Adeyeye tok.

And dis patulin if you chop e go fit trigger liver, spleen and kidney damage.

No be only NAFDAC don condemn dis fruits dem, even di centre for Food Safety (CFS) of Hong Kong’s Food and Environmental Hygiene Department don raise alarm tey tey. Dem say di Patulin level for dis fruit juice dey very high.

Dia claim be say if pipo chop di Pure Tassie Organic Apple and Blackcurrant Juice wey come from Australia, di toxic level of di patulin go fit affect dia immune system, make dem di vomit, get nausea and gastrointestinal wahala.

Blackcurrants

Getty Images

NAFDAC oga later beg friuts importers, distributors, retailers dem make dem stop to import di fruit enta di kontri sake of di health wahala wey e go cause millions of Nigerians.

E further ask all those wey dey still get di fruit for dia shops, warehouse or homes, make dem shaperly submit am to di nearest NAFDAC office.

She also ask healthcare professionals and consumers to report if dem find out say any side effect afta dem eat di fruits dem to any NAFDAC office close to dem.