Latest on coronavirus in Nigeria: Churches, Mosques fit reopen for Lagos but wit conditions – See dem here

Lagos authorities don give green light for churches to resume but wit conditions.

Tori be say Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don tok say churches and mosques fit open starting from June 19.

Govnor Sanwo-Olu tok dis one on Thursday as im dey address tori pipo on Covid-19 for di state house Marina.

Im say mosques go reopen from June 19 while churches go begin services from June 21.

Di Lagos govnor add say pipo wey don pass 65 years old no go fit attend church or mosque for now.

Di govnor announcement dey come after di Presidential Task Force bin say religious centres fit re-open but give dem some rule to follow.

Lagos get di highest number of coronavirus cases for Nigeria. Di state wey also be Nigeria commercial capital get 5440 confam cases with 67 deaths. 878 pipo don recover from di disease.

See di condition here

  • All religious centres (churches and mosques) must be 40% of dia venue capacity.
  • No hugging, handshakes, serving of food e.g. holy communion etc for any religious centre
  • Children wey dey less dan 15 years no de allowed to go.
  • Religious gatherings go only happun on Friday and Sunday.
BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC