Covid-19: Nigeria latest travel protocol for vaccinated and non-vaccinated foreign travellers

airport

BBC
All passengers must do scan to check dia temperature before dem go enta plane

Nigeria goment don release di revised travel protocol wey go take effect from Monday, 25, October, 2021.

Chairman of di Presidential Steering Committee/ Secretary to di Government of di Federation, Boss Mustapha, na im sign di statement dem release.

From Monday, travellers wey dey arrive Nigeria must present negative Covid-19 PCR test result wey dem conduct not more dan 72 hours before boarding.

Oda tins wey dey di travel protocol

  • Unvaccinated and partially vaccinated inbound passengers go dey required to observe a mandatory 7-day self-isolation in addition to a Covid-19 PCR test on day 2 and 7 afta arrival.
  • Fully vaccinated inbound passengers no go dey required to observe di mandatory seven-days self-isolation but dem go dey require to do a Covid-19 PCR test on day 2 of arrival.
  • Pesins wey dey arrive on “Business” trip or on official duty wey dey stay less dan 7 days in Nigeria must be fully vaccinated,
  • Produce negative Covid-19 PCR result 72hours before boarding; and
  • Conduct PCR test on day 2 of dia arrival.

Di PSC Chairman, Boss Mustapha, bin don tok during di national briefing, say dem go publish a revised travel protocol. Di review of di protocol dey based on science, national experience, and global developments.

Dis one dey come even as kontries like US, UK too don revise dia travel protocol.

For dia latest review, America say dem go reopen dia borders to fully vaccinated travellers from 33 kontris on 8 November, 2021.

Under di new rules wey di White House announce, pipo wey dey vaccinated wey test negative 72 hours before dem travel go dey allowed to enter.

Di move mark di end of di tough restrictions wey America compulsory for travellers since early last year.

Meanwhile, UK bin release dia own revised rule wey include say from Monday 11 October 2021, fully vaccinated travellers from Nigeria go dey able to come England.

Dem no need to provide pre-departure test, do di 8 day test or self-isolate for 10 days.

But dem say dem go need to book and pay for Covid test on dia second day.