Wetin you need to know about NIMC self-service system wey go allow you update your NIN from your phone

Nigerians no go need to dey visit di National Identity Management Commission (NIMC) enrolment office anytime dem wan update any informate on dia National Identification Number again.

Dis na as di NIMC announce say dem don launch one self-service modification portal wey go enable Nigerians to fit easily make any changes on dia NIN details wit just dia phone.

NIMC wey announce di informate on dia X account say, “please dey informed say as part of our ongoing efforts to enhance di National Identity Management System, modification activities no longer go dey conducted for our enrolment centre.”

Di commission explain say dis process dey convenient and easy as e go allow citizens update dia information anywhere and anytime.

NIMC say dis self-service modifications dey important as e go erase di long time wey pipo take dey go queue for enrolment centre.

Apart from dat, “e go improve security of data bicos na secure online platform and e increase efficiency, faster processing and approval”, di commission add.

According to NIMC, ova 100 million Nigerians dey registered wit di National Identification Number.

Wetin be di NIN Data you fit change yourself?

According to di informate from NIMC, di data you fit change by yourself for now na your name, date of birth and address.

  • Name: To change your name, you go need upload either a newspaper publication, court affidavit or marriage certificate or oda goment ID.
  • Date of Birth: To correct your date of birth, you go need Digitised National Population Commission (NPC) Attestation Certificate for those dem born bifor1992 and Digitised NPC Birth Certificate for those dem born afta 1992.
  • Address: Documents wey you go need na di Utility bill, Tenancy agreement and Community leader attestation letter.
  • Phone Number: You go need police report.

NIN data wey you neva fit change by yourself

NIN data wey you neva fit change by yourself include:

  • Change of State or Origin
  • Marital status
  • Maiden name
  • Picture update

How to do self-modification on di NIMC portal

NIMC advise kontri pipo wey wan modify dia details to start by verifying dia NIN and log on to dia website.

Select di details dem wan change, upload di documents, submit dia modification request and ensure to check di attestation box bifor dem submit dia request.

Di commission say di process dey easy and convenient.

Source