Wen Nigerian Youth Corps members go begin receive 77,000 naira new ‘alawee’?

Some members of di National Youth Service Corps, NYSC, don take to social media to complain as goment pay dem di old allowance wey be N33,000 instead of di newly approved of N77,000.

Di management of NYSC bin announce on September 25 say President Bola Tinubu don approve di increment of corps members allowance from 33,000 to 77,000 naira in line wit di increase in di national minimum wage.

Di statement bin tok say di increment go take effect from July 2024 wey mean to say di corps members go receive arrears of two months.

However, wen di corp members receive alert for dia September allowance, na still 33,000 naira dem see.

“We bin dey expect di alawee since last week, around 28 or 29 of September wey we normally receive our pay, but we no see am until last night (October 2) wen my own enta and I see say na still 33k,” one corps member wey no wan reveal im name tell BBC Pidgin.

Di corps members bin dey expect say goment go pay dem bulk sum of 165,000 naira, wey suppose include di two months arrears of July and August wey be 88,000 naira plus di Septemba new allowance of 77,000 naira.

“Some of my friends sef don dey boast about how dem go use di plenty money do one or two, but me, thank God say I no too get hope for di money. I just happy as I see di 33k bicos I don already dey para,” di corps member tok.

On social media platform X, one corps member wey her username na BomeHardo joke say she bin dey plan to buy car wit di arrears wey NYSC go pay her but dem don disappoint.

Wen NYSC go begin pay di new allowance?

Di Acting Director of Press for di NYSC headquarters for Abuja, Caro Lembu, tell BBC Pidgin say di corps members go still receive dia money.

“Shey na just last week di goment approve di increment and we make di announcement? So e dey too soon for it to dey effected. I dey sure say di goment dey work on am. E go take small time bifor di implementation go happen,” she tok.

“Dis no be di first time sometin like dis dey happen na. E get plenty adjustment wey need to happen. Na di same tin happen wit di workers (for di minimum wage matter), so e no dey peculiar.”

Lembu tok say as goment don already make pronouncement, dem must to pay di corps members di new allowance amount and e go must take effect from dat July 2024 as dem bin don announce.

“Dem no get anytin to worry about,” she tok.

NYSC na one-year mandatory national service scheme wey goment set up for 1973 for evribody wey graduate from University for Nigeria bifor di age of 30.

Under di scheme, goment go send di fresh graduates go oda states wey no be dia state of origin or wia dem study. Dis na to increase di spirit of togetherness and unity for di youths of di kontri.

For dat one year of service, dem go post di corps members go different goment institutions, majorly primary and secondary schools wia dem go work and also engage diasef for community development services.

Di allowance na stipend wey goment dey pay dem evri month for dia upkeep. E dey usually dey tied to di national minimum wage.

Nigeria dey currently go through economic difficulty wit inflation around 33% and cost of food and transportation dey very high, and as di Labour organisations start to demand for higher pay, goment agree to raise di national minimum wage from 30,000 to 70,000 naira.

And accordingly, dem also increase corps members allowance – or alawee as dem dey call am – to 77,000 naira.

Source