30 days Confab, economy and security – Highlights of President Tinubu Independence Day broadcast

Nigeria President Bola Tinubu don announce di gathering of a National Youth Conference to address di different challenges and opportunities wey dey face young pipo for di kontri.

President Tinubu tok wen im address di nation for im second Independence Day Broadcast and Nigeria 64th anniversary say di conference go “provoke meaningful dialogue and empower our young pipo to participate actively in nation-building.”

E say dis go dey possible by by ensuring say dia voices dey heard in shaping di policies wey dey impact dia lives.

Di Confab go last for 30 days and e go touch on issues like education, employment, innovation, security, and social justice.

Di president add for im address say di details of di Confab and selection of di delegates go dey designed in close consultation with di young pipo through dia representatives.

Oda youth-centric programmes wey di president say di administration dey do na di 3 million Technical Talents programme (3MTT) of di Ministry of Communications, Innovation and Digital Economy, wey dey aimed at building Nigeria technical talent.

Also, di implementation of Nigerian Education Loan Fund (NELFUND), to provide loans to students to pursue their tertiary educational dreams.

Di administration say later dis month, dem go launch The Renewed Hope Labour Employment and Empowerment Programme (LEEP), part of di effort of di Federal Ministry of Labour and Employment to facilitate di creation of 2.5 million jobs, directly and indirectly, on an annual incremental basis.

President Tinubu say government go soon announce all di beneficiaries of di national honours for 2024.

E confam say di Senate President and di Chief Justice of the Federation don get di honour of the Grand Commander of the Order of the Niger (GCON). Di deputy Senate President and Speaker of the House of Representatives get di honour of Commander of the Order of the Federal Republic (CFR), while di deputy speaker of the House do dey awarded Commander of the Order of Niger (CON).

Di president broadcast also touch on di high cost of living for di kontri, di economy and security.

“Fellow Nigerians, as I address you today, I dey deeply aware of di struggles many of una dey face in dis challenging times. Our administration know say many of una dey struggle with rising living costs and di search for meaningful employment. I want to assure una say una voices dey heard.

As your President, I assure you say we dey committed to finding sustainable solutions to reduce di suffering of our citizens. Once again, I plead for your patience as di reforms we dey implement show positive signs, and we dey begin to see light at di end of di tunnel.” Tinubu tok.

Security

On security, President Tinubu say im administration dey win di war on terror and banditry.

“Our target na to eliminate all di threats of Boko Haram, banditry, kidnapping for ransom, and all forms of violent extremism. Within one year, our goment don already eliminate Boko Haram and bandit commanders faster dan ever.

As of di last count, over 300 Boko Haram and bandit commanders don dey eliminated by our gallant troops for di Northeast, Northwest, and some oda parts of di country.” E tok.

“We don restore peace to hundreds of communities for di North, and thousands of our pipo deo dey able to return home. Na unfinished business, wey our security agencies dey committed to ending as quickly as possible. As soon as we fit restore peace to many communities for di troubled parts of di North, our farmers fit return to dia farms. We expect to see an increase in food production and a downward spiral in food costs. I promise you, we no go shake on dis mata,” Tinubu add.

Economy

On di economy, di president say e dey undergo di necessary reforms to become better and more sustainable.

E add say if di reforms no happen, to correct the fiscal policies wey lead to di current economic downturn, Nigeria go face an uncertain future and unimaginable consequences.

“Fellow compatriots, our administration dey committed to free enterprise, free entry, and free exit in investments while maintaining di sanctity and efficacy of our regulatory processes.

Di president add say sake of di reforms, di kontri bin attract foreign direct investments wey worth more dan $30 billion in di last year.

“Di more disciplined approach adopted by di Central Bank to monetary policy management don ensure stability and predictability in our foreign exchange market. We inherit a reserve of over $33 billion 16 months ago. Since den, we don pay back di inherited forex backlog of $7 billion.

We don clear di ways and means debt of over N30 trillion. We don reduce di debt service ratio from 97 per cent to 68 per cent. We don manage to keep our foreign reserve at $37 billion.”

On di ogbonge problem of di high cost of living wey pipo for di kontri dey face, especially for di areas of how food don cost, di president say di palava na di same tin many around di world dey face as prices and di cost of living continue to rise worldwide.

“My fellow Nigerians, be assured say we dey implement many measures to reduce di cost of living here at home.

I commend di govnors particularly, for Kebbi, Niger, Jigawa, Kwara, Nasarawa, and di Southwest govnors wey don embrace our agricultural production programme. I urge oda states to join di Federal Government in investing in mechanised farming.

We dey play our part by supplying fertilizer and making tractors and oda farm equipment available. Last week, di Federal Executive Council approve establishing a local assembly plant for 2000 John Deere tractors, combine harvesters, disc riders, bottom ploughs and oda farm equipment. Di plant get a completion time of six months.”

President Tinubu also add say di Federal Executive Council don approve di Economic Stabilisation Bills, wey go make business environment more friendly, attract investment and reduce di tax burden on businesses and workers once dem pass dem into law.

Source