End SARS Mass burial: Lagos state government clarify memo about 103 pipo dem wan bury plus wetin we know

Foto of wia dem do mass burial for Benue state

Getty Images

Di Lagos state goment don confam tori say dem wan do mass burial for di state.

Di goment however clarify say di mass burial no be for victims of the historic 2020 End Sars protest wey shake di kontri.

Dem specifically say di 103 deadi body dem wey goment wan bury no be from di incident wey happun for Lekki tollgate.

Goment for statement dem release on Sunday insist say dem no see deadi body for di Lekki tollgate.

Tori begin spread over di weekend afta one social media user share document wey show say Lagos state goment dey plan mass burial.

Di document wey pipo first tink say na fake show say goment don approve over N60million for di mass burial of 103 deadi body dem.

“For di records, di Lagos State Environmental Health Unit pick up deadi body dem after di End SARS violence and community clashes for Fagba, Ketu, Ikorodu, Orile, Ajegunle, Abule-Egba, Ikeja, Ojota, Ekoro, Ogba, Isolo and Ajah areas of Lagos state,” Dr Olusegun Ogboye tok.

Ogboye wey be di permanent secretary for di Ministry of health for di South west state add say “Jailbreak” bin happun for Ikoyi Prison.

“Di casualties mentioned for di document no be those incidents and NOT from Lekki Toll-gate as pipo dey allege. For di avoidance of doubt, we no collect any deadi body from di Lekki Toll Gate incident.”

Di leaked memo and Lagos goment response

Di memo wey carry all di informate dey come almost three years afta di incident.

Di memo about di burial carry 19 July 2023.

Di document also show wia dem tok about taxes and necessary deductions wey di approved company go remit. E get details of di process of di burial for di company wey dem give di contract.

For dia response, di Lagos State Ministry of Health say di letter na true but pipo dey misplace di matter dem.

Dr Olusegun Ogboye wey sign di statement argue say di pipo wey dem wan bury na from incidents of violence wey happun afta di EndSARS protests.

E say di Lagos State Environmental Health Unit (SEHMU) bin pick up plenty deadi body afta di End SARS violence and community clashes.

“Afta di End SARS violence di office of di Chief Coroner invite members of di public wey lose dia loved ones or pipo wey declare dia family members missing between 19th and 27th October 2020 from various clashes to contact di department of Pathology and Forensic Medicine of di Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH) to help wit identification of these casualties dem deposite for State-owned morgues.

“Relatives go undergo DNA tests for identification purposes. E dey important to state categorically say nobody respond to claim any of di deadi body dem.

“However, afta almost three years, di deadi body dem remain unclaimed, adding to di congestion of di morgues,” di permanent secretary tok.

Di memo, plus Lagos state goment explanation no tok anythin about wne di burial go happun or how dem go spend di money

Since di protest in 2020, both di Lagos Government and di Federal don deny any mass killing during di End SARS protests. Plus Lagos state goment also set up a panel to chook eye into dia mata and publish dia findings.

Wetin dey di judicial panel report

For October 19th, 2020, Lagos State put togeda di committee for di ‘Judicial Panel of Inquiry on Restitution for Victims of SARS Related Abuses’ wey go look into di protest wey dey rock di kontri den. Na wen di Lekki tollgate incident happun for October 20, 2020 come make Govnor Babajide Sanwo-olu add to di duties of di committee.

Di committee siddon to check all di evidences wey some pipo submit say ‘massacre’ happun for lekki tollgate.

For di report wey Justice Doris Okuwobi chair, dem confam say na about 46 casualties security forces shoot for lekki tollgate on October 20, 2020.

Di report show say nine pipo die, 22 sustain injury from gunshots, di military assault 11 and 4 dey presumed dead.

Di 309-page report wey dem title ‘Report Of Lekki Incident Investigation Of 20th October 2020’ show di findings wey di panel arrive for dia meetings. Dem submit di report give Govnor Sanwo-olu.

Di panel put for dia report say soldiers shoot live ammunitions at protesters wey no carry any arm.

Some of di pipo wey dem confam say dem die for lekki tollgate include: Folorunsho Olabisi, Olamilekan Ajasa, Kolade Salami, Victor Ibanga, Abuta Solomon, Jide, Olalekan Ashafa, , Kenechukwu Ugoh, Nathaniel Solomon.

For di report, dem write say 22 pipo sustained gunshot injuries for Lekki tollgate wen di mata happun.

Di panel report confam say soldiers wey comot from di 65 Batallion of the Nigerian Army led by Lt. Col Bello carry ‘blank and live ammunitions’ ontop say dem wan go disperse protesters.

“Soldiers carry blank and live bullets wey dem point directly for di midst of di protesters for Lekki tollgate, wit di deliberate intentions to assault, maim and kill.”

Inside di panel report na im dem put say “soldiers send back ambulances wey dem invite to rescue pipo wey don wound for di incident.”

Di panel also confam say plenti witnesses no dey ready to speak ontop di incident becos say dem dey fear harassment by security pipo. E dey clear say some protesters dey fear becos na strange person dey trace dia location and no fit comot for wia dem dey save dia own life.

October 2020 EndSARS protest

October 2020 EndSars protest for Lagos

Reuters

October 2020 suppose be Nigeria 60th birthday month but e be period of violence and killings across di west African kontri afta one peaceful protest against police brutality turn bloody.

Di destruction start afta jaguda pipo hijack di End SARS protests wey thousands of pipo enta streets across Nigeria to peacefully demonstrate against police brutality for di kontri and end to di SARS police unit.

‘Anger and shock’, dat na how Nigerians and pipo around di world react to di violence wey happun afta armed security operatives shoot #EndSARS protesters on Tuesday around 6:45pm for Lekki toll gate for Lagos.

Amnesty international bin claim say Nigerian army and police kill at least 12 peaceful End SARS protesters for two locations in Lagos wey be Nigeria commercial city.

One Nigerian Disk Jockey DJ Switch wey bin do Instagram live video from Lekki toll gate wen di whole kasala burst say she count 15 deadi bodi dat night alone.

But initial corona investigation by di Lagos state goment bin tok say nobody die.