Oasis: Five tins to sabi about di band wey dey do comeback afta 15 years

Oasis group for 1996 wey include Alan White, Paul 'Bonehead' Arthurs, Liam Gallagher, Paul McGuigan, Noel Gallagher

Getty Images
Oasis group for 1996 wey include Alan White, Paul ‘Bonehead’ Arthurs, Liam Gallagher, Paul McGuigan, Noel Gallagher

British rock band, Oasis announce dia reunion tour for 2025 afta dem don separate for 15 years.

Dem make dis announcement for dia social media page on Tuesday say, “di guns don silent. Di stars don align. Di great wait dey ova. Come see. E no go dey televised”.

Di reunion dey come for di 30th anniversary of dia first album wey make dem blow wey dem dey call, Definitely Maybe.

Di group ogbonge hits bin include Wonderwall, Don’t Look Back In Anger and Stop Crying Your Heart Out.

Fans of di group bin don dey beg dem to reunite since dem break up for 2009 sake of one backstage fight for di Rock en Seine festival for Paris.

Members of the band

Oasis in 1993

Getty Images
Oasis in 1993

Oasis first start for Manchester of 1991.

Dia original members bin dey five wey include Liam and Noel Galleger, guitarist Paul “Bonehead” Arthurs, bassist Paul “Guigsy” McGuigan and drummer Tony McCarroll.

Ova time di line up of artists change apart from di Gallegher brothers.

Di rolling cast of musicians include Andy White, Gem Archer, Andy Bell, Zac Starkey and Chris Sharrock.

But di remaaining of di band bin stay wit Liam wey form di new band Beady Eye wey scata for 2014.

2.5 million fans for one concert?

Oasis 1996 concert

Getty Images
Oasis 1996 concert

Di band na very big deal back in di day and some pipo tink say e go carry dem through dia reunion world tour.

To sabi how big dem bin dey, about 2.5 million pipo bin apply for di opportunity to fit appear for two of di shows dem bin dey do for 1996.

Break up

Di band officially scata for 2009 afta kasala burst for one Paris festival.

Noel tok say during argument, Liam bin try nack am wit guitar.

E say di wahala start afta im block Liam say make im no advertise im clothing brand for di V festival wey dem suppose perform for.

Noel, wey be di lead guitarist and chief songwriter dem quit di band say im no fit work wit im broda Liam.

Cool Britannia

Tony Blair and Noel Gallagher

Getty Images
Tony Blair and Noel Gallagher

Wen Tony Blair bin win for landslide for 1997, e bin invite di group make dem come shack small in celebration for Number 10.

Di picture of di then Prime Minister and Noel dey shake hands tirn to di ogbonge foto of di era wey dem dey call Cool Britannia wey be shirt time wen pride bin dey for British culture during di late 1990s.

Noel remember am say, “I bin dey 30 years, dey high on drugs and everibodi dey tell us day we be di greatest band since who knows, then di prime minister come invite you to come drink wine. E all dey part of di high.”

Gen Z sef like dem

Oasis even reach TikTok, even afta dem don break up.

23 year old Live dey call herself The Oasis Girl for social media dey sing covers of di band online and call Noel, “di greatest lyricist of all time”.

Anoda 23 year old wey dem dey call Katie say she first hear di band songs as pikin and still dey here dem as adult for TikTok and dem still get “di draw”.

Records show say young pipo dey listen to 90s music even pass music from dis decade, say di reason fit be sake of nostalgia.

Source