How Supreme Court take decide di elections of Bayelsa, Imo and Kogi states

Di Supreme Court don deliver judgments for di appeal wey challenge di govnorship elections of 11 November, 2023 for Bayelsa, Imo and Kogi states.

A five-member panel of justices, wey Justice Mohammed Garba lead, bin reserve judgement of di matas after dem hear arguments from di parties wey dey involved.

On Friday, 23 August, di Supreme Court uphold di elections of di three govnors as dem dismiss di appeal of opposition voices.

Bayelsa State

Douye Diri

Douye Diri
APC candidate Timipre Sylva bin dey contest di validity of Gov. Douye Diri election

Supreme Court rule say Sen. Douye Diri na di duly elected govnor of Bayelsa State, south-south Nigeria.

Di highest court for Nigeria also dismiss di appeal wey Timipre Sylva of di All Progressives Congress (APC) carry come dia dormot for lack of merit.

Di five-member Supreme Court panel agree wit di Appeal Court judgement of 15 July wey tok say di appeal of di former Bayelsa State govnor na abuse of court process as im bin file two notices of appeal.

Di off-cycle election bin happun on 11 November, 2023 and Douye Diri of di Peoples Democratic Party (PDP) win afta im poll 175,196 votes to beat Timipre Sylva wey bin get 110,108 votes.

Kogi State

Di court also confam di election of Usman Ododo of Kogi State.

Di Supreme Court confam am afta dem dismiss di appeal wey Murtala Ajaka, di candidate of di Social Democratic Party file, wey challenge di outcome of di election.

For di unanimous judgment, di Supreme Court uphold di decision of di Court of Appeal wey bin rule in favour of di election of Ododo on 27 May.

Di five-man panel hold say di SDP govnorship candidate no fit prove di allegation of substantial non-compliance wit di Electoral Act. Wey mean say di election actually follow wetin Nigeria law tok contrary to wetin di challenger bi tink.

Dem add say di allegations of fake age and certificate forgery na pre-election mata wey di Federal High Court wey get jurisdiction to hear dat kain mata suppose don address.

Di Supreme Court dismiss Ajaka appeal sake of lack of merit.

Di election bodi for Nigeria wey be di Independent National Electoral Commission (Inec) bin declare Ododo winner afta im poll a total of 446,237 votes to beat Ajaka wey bin poll 259,052 votes for di 11 November 2023 govnorship election for di state.

Imo State

Hope Uzodinma

Hope Uzodinma
Ri Supreme Court dismiss di case by Accord party but decide on di Labour Party case against Governor Uzodinma win

For di Imo govnorship case, di Supreme Court dismiss di appeals by Accord Party (AP) and Allied Peoples Movement (APM) wey challenge di election of Govnor Hope Uzodinma of di All Progressives Congress (APC) for lack of merit.

Di court order AP to pay one million naira each to di Independent National Electoral Commission (INEC), APC, and Uzodinma to cover di costs of dia responses to di appeal.

Dem also order APM to pay two million naira each to INEC, APC, and Uzodinma.

Di five-member panel of di court also dismiss di appeal wey Peoples Democratic Party (PDP) and dia candidate, Samuel Anyanwu, bin file.

Di panel unanimously agree say di appeal no get merit and dem resolve all di issues in favour of di govnor.

Di court also dismiss di appeal of di Labour Party (LP) and dia candidate, Athan Achonu for lack of merit.

Source