Profile of Justice Kudirat Kekere-Ekun wey NJC recommend as di next Chief Justice of Nigeria

Di National Judicial Council don recommend Justice Kudirat Motonmori Kekere-Ekun to President Bola Tinubu for appointment as Chief Justice of Nigeria.

NJC tok-tok pesin, Soji Oye for inside statement say dem take di decision for dia Council meeting wey di CJN Justice Olukayode Ariwoola lead.

“E dey important as Hon. Justice Olukayode Ariwoola, go formally bow out of office as Chief Justice of Nigeria next week Thursday, 22 August 2024,” according to di statement.

Justice Olukayode Ariwoola don siddon for dat seat since im collect appointment from former President Muhammadu Buhari for September 21, 2022.

Conditions importers gatz meet to benefit from food import duty waiver wey Tinubu approve

Officially, im go bow out on August 22, wen im reach di retirement age of 70.

Di tradition of di highest court for di land na say, di next most senior Justice go likely step in as di CJN.

Di Supreme Court currently dey complete wit 21 Justices.

If dem confam her as di next CJN, Justice Kekere-Ekun go become Nigeria second female CJN afta Justice Aloma Mukhtar, wey bin serve between July 2012 and November 2014.

Meanwhile, NJC also “recommend (27) candidates for appointment as Judges of States Courts and a candidate for appointment as Kadi of the Sharia Court for FCT, Abuja to various State Govnors and Mr. President.”

Who be Justice Kudirat Kekere-Ekun

Justice Kudirat Motonmori Olatokunbo Kekere-Ekun na one of di top female Justices for di Supreme court of Nigeria.

Dem born her for May 7, 1958. She be 66 years old.

Justice Kekere-Ekun get her law degree from University of Lagos and dem call her to bar for 1981.

For her LL.M, she get am from di London School of Economic and Political Science for November 1983.

Her legal career start from Lagos south west Nigeria.

She collect appointment as Senior Magistrate Grade II, Lagos State Judiciary for December 1989.

And den become Judge of di High Court of Lagos State for July 1996.

She serve as Chairman Robbery and Firearms Tribunal, Zone II, Ikeja, Lagos from November 1996 to May 1999.

And for September 22, 2004, she step up as Justice of the Court of Appeal.

Na from dia she collect appointment go Supreme court for June 8, 2013.

Aside law, she dey enjoy reading, music, information technology and counselling.

Past Chief Justices of Nigeria

Hon. Justice Stafford Foster Sutton – 1955-1958

Hon. Justice Adetokunbo Ademola – 1958-1972

Hon. Justice Taslim Olawale Elias – 1972–1975

Hon. Justice Darnley Arthur Alexander- 1975–1979

Hon. Justice Atanda Fatai-Williams – 1979- 1983

Hon. Justice George Sodeinde Sowemimo – 1983–1985

Hon. Justice Ayo Gabriel lrikefe – 1985–1987

Hon. Justice Muhammed Bello – 1987–1995

Hon. Justice Muhammadu Lawal Uwais- 1995–2006

Hon. Justice Salisu Modibo Alfa Belgore – 2006–2007

Hon. Justice Idris Legbo Kutigi – 2007–2009

Hon. Justice Aloysius Iyorgyer Katsina-Alu – 2009–2011

Hon. Justice Dahiru Musdapher – 2011–2012

Hon. Justice Aloma Mariam Mukhtar – 2012–2014

Hon. Justice Mahmud Mohammed – 2014–2016

Hon. Justice W. S. Nkanu Onnoghen – 2016- 2019

Source National Judicial Council

Source