Police for Ghana dey find boys wey harass female senior high school student inside viral video

Di Ghana police don chook eye inside one viral video wey show some young boys wey dey harass one female student for school for di Ashanti region for Ghana – Kumasi Academy.

Inside di disturbing video, more dan ten boys dey pursue di young girl wey dey in school uniform, and dey shout at am.

Some of di boys bin dey push am, odas dey hit am wey some too dey hoot at am.

Di young girl bin wear dress many females dey wear for boarding house – wey im dey in front of di crowd of boys.

As dem dey follow am, one boy carry tree branch hit am for back.

At one point inside di video, one man wey dey hold torchlight and stick, carry leg hit di young girl and she fall down – di odas for back still dey shame am.

Di pipo don dey accuse di young girl inside di video say im engage in sexual activities for di school.

Kumasi Academy dey find di students

Sources within di school administration confam say di incident happun for di school wey all di pipo inside di video na final year students of di school.

Di source also tok BBC News Pidgin say dem get information say di incident don happun at midnight as di students don dey learn late into di night.

Di school bin set up committee togeda wit di municipal education directorate say dem go get to di bottom of di mata.

But even as dis committee go start dia work, di school don condemn wetin happun inside di video.

Police begin investigation

Afta di video don go viral, di Ghana police enta di mata. For one brief post for dia social media handles, di Service tok say dey don dey look into di mata.

“Di police begin to dey investigate di viral video wey capture a group of young men wey don dey harass one female student.”

Dey add say, “We don dey assure di public say we go find di pipo wey dey responsible, we go arrest dem wia dem go face justice.”

As of Wednesday 14 August, di police don visit di campus of di Kumasi Academy to question some of di authorities as dem try to fish out di boys inside di video wey don harass di female student.

Source