How to watch Nigerians wey dey schedule to compete for a medal for Olympics Day 11

Paris 2024 Olympics

Getty Images
Blessing Oborududu/Favour Ofili

Nigeria contingent wey go di 2024 Olympic games for Paris, France neva win any medal so far but hope still dey for Team Nigeria.

On Tuesday wey be Day 6 of di ongoing Olympics, Nigeria dey scheduled to compete for four events. Two of dis events na for gold and bronze medals.

Nigeria track queen Favour Ofili go compete for di women’s 200 metres final.

Di Nigerian athlete wey bin dey para say dem comot her name for di 100m race don become one of Nigeria medal hopeful for di women 200m for di Olympics.

Nigerian authorities react afta Favour Ofili para say dem comot her name from 100m Olympic race

Japan end Nigeria Super Falcons dream for di Olympics 2024 as dem waya dem 3-1

Very, very close! – How Noah Lyles beat Kishane Thompson to win Paris Olympics gold

2024 Olympics Favour Ofili and Julien Alfred

Getty Images
Julien Alfred of Team Saint Lucia and Favour Ofili of Team Nigeria compete during di Women’s 200m Semi-Final on day ten of di Olympic Games Paris 2024 for Stade de France on August 05, 2024 in Paris, France.

Favour wey her nickname na ‘star girl’ end di race wit season best of 22.05s to finish second just behind Julien Alfred wey win di race.

She be three-time world championships semifinalist – 400m for 2019, 200m for 2022 and 2023. She dey currently hope for medal at di ongoing Olympics.

Ofili wey be first time Olympian na di first Nigerian woman to qualify for di final of di 200m at di Olympics in 28 years.

Di last time a Nigerian make di final of women 200m na for Atlanta 1996 wen Mary Onyali win bronze medal.

For Blessing Oborududu, she bin win Nigeria first Olympics medal ever for Wrestling for 2020 Olympics for Tokyo.

Di Tokyo silver medallist go compete for bronze for di 68kg Women’s freestyle event afta she lose her semi final match 3-1 on Monday.

Blessing Oborodudu wrestling bronze medal event

Tokyo 2020 Olympics silver medallist, Blessing Oborududu go fight for bronze later dis evening.

Oborududu, bin lose her semi-final match against Meerim Zhumanazarova of Kyrgyzstan 1-3 on Monday, wey for see her reach anoda Olympic final.

Di semi-final bout of di women 68kg wrestling event for 2024 Paris Olympics bin take place for di Champ-de-Mars Arena.

Earlier in di day Oborududu bin defeat her Canadian opponent, Linda Morais, 8-2 for a place for di quarter-final.

She enta mat again for di quarter-final and defeat Larroque Koumba of France 6-2 to kotinu her good start for Olympics before she lose her semi-final to Zhumanazarova.

Favour Ofili 200m final

Ofili make history on Monday by becoming di first Nigerian woman in 28 years to reach di 200m final, matching Mary Onyali achievement for di 1996 Atlanta Olympics.

She achieve a personal season best of 22.05s, to finish second for her semi-final heat behind Julien Alfred, wey be di reigning Olympic 100m champion.

How to watch Favor Ofili and Blessing Oborodudu events

All di events from Paris 2024 including wrestling and Athletics go dey live on Supersports.

Team Nigeria schedule for Day 11

Team Nigeria get 11 athletes wey go compete for three sports: canoe sprint, athletics, and wrestling.

Around 5:15 p.m Nigerian time Blessing Oborodudu to dey on di mats for her Bronze medal match.

By 8:40 p.m, Favour Ofili go race for Gold medal for di Women’s 200m final.

By 6:35 p.m Samuel Ogazi go run for di Men’s 400m semi final.

Around 11:50a.m, Chinecherem Nnamdi go compete for di Men’s Javeline throw.

Oda African Athletes to watch on Day 11

7:50pm: Athletics – Men’s 1 500m final, Timothy Cheruiyot, Kenya

8:14pm: Athletics – Women’s 3 00m Steeplechase final, Peruth Chemutai, Uganda

8:44pm: Athletics – Women’s 3 00m Steeplechase final, Faith Cherotich, Kenya

Wia to watch am

You fit watch di action live for Supersport channel for DSTV or you fit come back to dis tori as we go dey update di action as e dey happun.

Source