United Arab Emirates tok how pipo fit apply for dia visa as dem deny ownership of some websites

Di United Arab Emirates (UAE) Federal Authority for Identity and Citizenship, Customs & Port Security, don tok say dem no be di owner of some websites for visa application wey some pipo attribute to dem na fake.

Dis dey come afta di kontri lift im visa ban on Nigeria and say dem fit apply from 15 July 2024.

Di Federal Authority for Identity and Citizenship, Customs & Port Security tell BBC News Pidgin say anybody wey wan apply for visa fit go through di tourist agency offices.

“Regarding visa requirements and fees, if you wish to apply for a tourist visa, weda wit single or multiple entries, you fit do so through di tourist agency offices.”

Dem say make pipo contact di General Directorate of Residency and Foreigners Affairs Dubai if dem want di visa from dia.

Na di Minister of Information, Mohammed Idris announce di informate of di lifting of di visa ban.

Di announcement dey come more dan two years afta di UAE suspend visa issuance to Nigerians.

“Following successful talks and extensive, mutually beneficial negotiations between di Government of di United Arab Emirates and di Government of di Federal Republic of Nigeria we reach agreement wey allow for di resumption of travel to di UAE for Nigerian passport holders.

Dis agreement include updated controls and conditions to facilitate obtaining a UAE visa,” di statement tok.

Meanwhile, Emirates go also resume services to Nigeria from 1 October 2024, and dem go dey operate a daily service between Lagos and Dubai.

Adnan Kazim, Emirates Deputy President and Chief Commercial Officer tok say di airline dey excited to resume dia services to Nigeria.

“Di Lagos-Dubai service don traditionally dey popular wit customers for Nigeria and we hope to reconnect leisure and business travellers to Dubai and onwards to our network of ova 140 destinations.

“We tank di Nigerian government for dia partnership and support in re-establishing dis route and we look forward to welcoming passengers back onboard,” Kazim tok.

Why Nigerians dey like go UAE?

Nigerians dey go United Arab Emirates (UAE) for various reasons.

One of di primary attractions na tourism. Di UAE, particularly Dubai and Abu Dhabi dey offer world-class attractions such as di Burj Khalifa, luxury shopping malls, and ogbonge beaches, and all dis dey draw Nigerian tourists wey dey find leisure and adventure.

Business and trade also play significant roles for dis trend. Di UAE strategic position as global business hub wit robust infrastructure and a favourable business environment appeal to Nigerian entrepreneurs and investors.

Many Nigerians travel to di UAE for trade fairs, business meetings, and investment opportunities, and dem dey contribute to di growing economic ties between di two nations.

Also, education and employment prospects dey lure Nigerians to di UAE. Di kontri high-quality universities and educational institutions dey attract Nigerian students wey dey seek advanced studies.

Additionally, di UAE booming job market dey offer lucrative opportunities for skilled professionals, and dis dey make many Nigerians to seek employment in sectors like hospitality and healthcare.

Source