Outcome of meeting between Labour leaders and Tinubu over minimum wage

Leaders of di Organised Labour meeting wit Nigeria President Bola Tinubu for di State House, Abuja, di kontri capital don end.

Di reason for di meeting na on top di new minimum wage and oda mata wey don dey ground for sometimes now.

President of di Nigeria Labour Congress (NLC) Joe Ajaero, President of di Trade Union Congress Fesuts Osifo lead dia respective teams for dis important meeting.

Di president neva make decision on top di 62,000 naira ($39) wey dem propose along wit di private sector and di 250,000 naira ($157) wey di organised labour dey demand.

Di meeting dey come afta di President tok for im Democracy Day speech on 12 June, 2024 say im go soon send one executive bill on di new national minimum wage for workers go di National Assembly for passage.

On 25 June, di Federal Executive Council (FEC) call for more engagement wit stakeholders on di minimum wage.

Two days afta, Tinubu and Vice President Kassim Shettima, for di 141st meeting of di National Economic Council (NEC), bin meet wit di govnors of di 36 states of di Federation and ministers to deliberate on a new minimum wage for workers.

On 3 June, di labour unions bin ground di kontri economy sake of di minimum wage kasala.

Di NLC and TUC bin first propose 494,000 naira ($311) as di new national minimum wage, as dem cite inflation and di economic hardship for di kontri.

Nigeria goment bin offer 60,000 ($35) wey di organised labour unions reject.

On 7 June, state govnors tok say dem fit no fit sustain N60,000 as minimum wage.

For di last meeting wit di tripartite committee, organised labour reject di 62,000 naira wey di goment dey propose and peg dia demand to 250,000 naira.

Di federal government don ask labour unions to demand a more realistic and sustainable wage.

Tinubu bin also direct Wale Edun, minister of finance, to present di cost implications for a new minimum wage.

Mohammed Idris, minister of information and national orientation, say di presentation go form di basis of further negotiations.

Source