How Banky W skin cancer journey take waka as e finally declare victory

Nigerian singer Banky W wey im real name be Bankole Wellington don announce say im don successfully undergo im fourth cancer surgery.

For im Instagram page, Banky W on Thursday 23 May share one long post wit title “Final Score – Christ 4 – Cancer Tumors 0”.

Dis go be di popular singer anoda successful surgery afta seven years.

Banky W bin tank im wife Adesua wey also dey im side for di hospital for one video wey di singer release.

Di singer urge im fans to get faith in God.

“Sometimes, your faith in God no go prevent di storms from coming… but e go carry you through dem. Faith no go always stop you from hurting, but e go help you heal, and e go help you deal.

“God neva tok say di weapons no go form, E promise say dem no go prosper. E neva tok say di enemy no go come… E promise say wen di enemy come in like flood, di Spirit of God go raise standard against am.

Banky W further tok say im post dis testimony to encourage anyone out dia wey dey go through one challenge or di oda.

‘If my wife bin no support me, I no for do politics’

‘Even as lead pastor, I go still dey act’ – Jimmy Odukoya

‘My eyes see plenti tins during election campaign’ – Regina Daniels Nwoko

E say e fit be it like say e big pass you, but greater be wetin dey inside you dan anytin you go face for dis world.

“Grateful for my wife, family, friends, and Pastors for dia love, prayers, and support. Tank God for my health and trust say dis latest victory na final in Jesus’ name,” di ogbonge singer add.

For 2017, Banky W bin reveal how e go through three successful surgeries to comot tumours from im shoulder.

Dat time too, na through one long social media post e bin share di news say e bin “treat one rare strain of skin cancer wey bin show face afta e first show 10 years ago”, den.

Wetin be skin cancer?

Skin cancer dey shele wen skin cells dey damaged, for example, by overexposure to ultraviolet (UV) radiation from di sun.

Na three main types of skin cancer dey:

  1. basal cell carcinoma (BCC)
  2. squamous cell carcinoma (SCC)
  3. melanoma – dis na di most dangerous form of skin cancer.

Both basal cell carcinoma and squamous cell carcinoma dey popular as non-melanoma skin cancer or keratinocyte cancers. Keratinocyte cancer dey more common in men, e almost double dat of women.

Melanoma na di most common cancer for Australians.

E also get some kind rare types of skin cancer including Merkel cell carcinoma and angiosarcoma. Dis one get im own special treatment kind.

Wetin dey cause skin cancer?

Na Australia get one of di highest rate of skin cancer for di world. Anypesin fit dey risk to develop skin cancer, though di risk dey increase as pipo get older.

Di most of skin cancers for Australi, na exposure to UV radiation for sunlight dey cause am.

Some factors wey dey increase risk of skin cancer include:

sunburn

tanning

solariums.

Diagnosis of skin cancer

E dey important to check your skin from time to time and check wit your doctor if you notice say any changes dey.

Treatment for skin cancer

Skin cancers almost always dey removed. For some more advanced skin cancers, doctors fit remove some of surrounding tissue to make sure say dem don comot all of di cancerous cells.

Di one wey common pass for treatment for skin cancer na surgery to remove di cancer – dat na under local anaesthetic.

Common skin cancers fit dey treated wit ointments or radiation therapy (radiotherapy).

Cryotherapy – to use liquid nitrogen to shaparly freeze di cancer off , curettage – to scrap or cautery – burn , na methods wey sabi pipo fit also comot cancer.

We dey update dis tori

Source